ASUU STRIKE ADVERTISEMENT!! ! Hehe!Yes O! E don happen again o. - TopicsExpress



          

ASUU STRIKE ADVERTISEMENT!! ! Hehe!Yes O! E don happen again o. Chukwudi Films in association wit Chukwuemeka Pictures present anoda ogbonge movie ASUU STRIKE 2013.Dis one na movie wey pass movie o!Dem no dey tell person dis one o!U must to watch am by urself&for urself.Come hear the true story behind the whole ASUU Strike. Who start am, why dem start am, who suppose end am and who no gree end am!U go c all for dis movie. Money don scatter our country o! Dis one dey ask 4 money, dat one say no money...ewoOooo o! Chai! Come see as University students dey suffer, see as crime don dey increase, girls dey born like fowl, yahoo boys dey press control enter ooo,see as lecturers kukuma don turn home teachers&some dey roger kabukabu with dem moto... Parents dey cry say their children don finish food for house. Ew ..see this mama she say na 4derica of rice she dey chop per month but now wey her pikin dey house, nah 1bag per month ooo...chai! See Bl...ood!See Blood!!See Blood!!! Students no gree ooo. Rich men no worry. Leaders no even send.Ewooooooo! Wetin poor man go do. Kai! ASUU STRIKE! ASUU STRIKE!! ASUU STRIKE 2013!! Full of Suspense, intrigues, romance, swagger, ginger...dat will keep u glued to d edge of ur seat. U go laff, u go cry and u go reason sef. ASUU STRIKE! ASUU STRIKE!! ASUU STRIKE 2013!!!. . . Grab ur copy now! Starring: Kanayo O. Kanayo as Goodluck Jonathan, Pete Edochie as Nassir faggie, Patience Ozokwor as Ngozi Okonjo- Iweala, Eucharia Anunobi as Prof.Ruqayyat, Jide Kosoko as Gabriel Suswan, Olu Jacobs as Prof Julius Okojie, Jim iyke as Yahoo boy, Saka as poor man o! ASUU STRIKE 2013! Grab ur copy now!!! Marketed and distributed by ogb&emmy Ltd. 7pound road Aba.
Posted on: Mon, 02 Dec 2013 10:23:31 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015