AUGUST 21TH, 2014. AUCHI POLY NEWS. Great Gbogbo, Great Gbagba, - TopicsExpress



          

AUGUST 21TH, 2014. AUCHI POLY NEWS. Great Gbogbo, Great Gbagba, Great Polytes, DORO MORNING. YABA YABA YABA!!! som students Fb/Bbm status. Abeg mak una no Vex,4d Late News way i day post nw, dose way like my fone Pass me, steal my fone 2days ago, also Lite no day for Sabo at all #The_Post_Utme_Cbt_Result_don_finally_Come_out. #HND_Form_Pending 1. WORLD NEWS: Stil on Ebola matter. for inside Sport, b lyk say Liverpool wan buy Balotelli USA, stil day find way 2 tackle BOKO HARAM, way EBOLA day ground. 2. SCAM ALERT: No Give your money to people way go help u do fake Admission. Be Wise!!! Mak una Warn Philipa O. Idogho, d ones way day facebook. For Those way der Post deir Babe number, say dem day Run Admission, mak una day Careful some of dem, Pass Fraudsters. 3. SCHOOL NEWS: Light scarce4 Auchi, as Students Begin day enta Hospital, Saloon, Beer Palour, Resturant jusz 2 Charge deir Readin Lamp and Phones, abeg mak una tak am easy. SPAT Result don com out: as dem Post some department yestaday, for Campus2, more loading. Students cum day complain as na only Final year own dem paste. SCH OF ICT, way day campus1, d renovation buildin, d ministry don day go2 d permanent site. Auchi poly Utme CBT Screenin Result don cum out, 2days ago. Dose way neva check mak una try go check for the SCH website, Note: na only BB,Android phones and Laptop u fit tak view am. Abeg for those way don check their CBT result online, waytin be una position for the list, how many names day the list, waytn be your score, abeg Specify your department. Applicants plenty diz Year way cum do CBT exam, D list of dept way we fit gather as of yestaday na mass comm 3712, acct 2047,slt 3494,comp sci 1299,archi tech 212, bus admin 3646, estate managment 263.fashion and clothing tech 65, art and design 154, we go get all d dept b4 dis week end. About The CBT score, dose way get high score una chances of gainin Admission day high, and also mak una no say, smtymz d SCH no day use score. For dose way get low Marks, mak una no worry, hope stil day. Na Admission go talk. For my Boss and Madam, way day cum 4 HND, abeg mak una no worry, News day reach us say, e don cum out, i enta bank yestaday, dem say, e go soon show face. #NOTE Change of Course form neva cum out. 4. ENTERTAINMENT: NIFES Music night, way near Campus1 gate na Today ooo, abeg mak una cum, GB plenty. MASS COMM DEPARTMENT day INVITE all of us to her MEDIA SWAGZ celebration, Date: 24-08-2014 (dis sunday), Venue: MR.BIGGS FUNCTIONING HALL,TICKET is #500 only. Red Carpet starts by 12pm. Come and experience d SWAGS OF MASS COMMUNICATION, for more info n TICKET pls contact: Joseph 07038977010 , Jeremiah 08134054349 5. ADVERT: Nokia C5, Nokia X2 dual sim for sale call 08101006164 6. SCHOOL INFO: *SUG NEWS: SUG Election na today b deir Manifesto 4 SCH Pavilion, Campus1. abeg Mak una Vote for the Right Person, way go get listenin Ear and helpin Hand. *AUCHI POLY EXAM: Regular Exam-School of Art&Design na next week, while the rest SCHOOL na next 2weeks. *SES Exam-na october time. *AUCHI POLY FORM: HND form neva cum out we go inform una wen e cum out. SPAT form na September period, e go tak show face. No fall 4,bad people hand. *AUCHI POLY ADMISSION LIST: ND/Bsc CBT result don Finally Come out, mak una go Check. 7. SPECIAL SHOUT OUT: *Erica Effizy: Congratulation to Gospel Echo, wish u all of u strength, peace, love nd greater levels, as u celebrate dis year miz nite, celebration will not depart frm ur mouth in jesus name. Amen. Love u all. Frm Erica to Nifes choir. *Ojo Peter Odion: day wish all d students sucexx 4deir upcomin examz n Nifes Music nite. 8. BIRTHDAY WISHES: Pending Request. 9. HELP LINE: 09094408154 , 08101006164 10. COMMENTARY: Abeg mak una they try they comment and share our post. Una happy New week. 11. NEWS CIRCULATION: our News they reach 80,000 Students/Aspirants. 12. CONCLUSION: This na the news way we get for the day. ABEG ALSO We need People to Work with, if you wan Enta our Voluntary work to day Give News abt AUCHI POLY n Beyond, about Factual tinz Happenin arund Campus and d world, ABEG FEEL FREE TO ADD ME OR INBOX ME2. #ATTENTION , ABEG if you get NEWS, ADVERT, BIRTHDAY, WISHES, SHOUT OUT ,abeg feel free to send tru d INBOX SO DAT E GO ENTA OUR Tomorrow publication. thanx.
Posted on: Thu, 21 Aug 2014 09:13:57 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015