Akpos travel go do business for anoda state, im come write letter - TopicsExpress



          

Akpos travel go do business for anoda state, im come write letter to im wife….. My dear Sulia, I no go fit send money dis month oo because business no dey too move, economy tight, infact global market crisis dey and don dey affect my business performance so na 100 kisses I dey send you. You be my sweetheart, my honey, my sweet potato abeg manage and adjust. Your loving husband Akpos His wife come reply am … My dear Akpos, papa lolo, honey mi. Thanks for di 100 kisses. Below you go see list of expenses wey I pay with di Kisses…: 1. Obiora wey dey sell provision agree give us provision for one week for 2 kisses. 2. Di NEPA man agree say im no go disconnect only after 7 kisses. 3. Oga landlord, Baba Tope dey come every day dey collect 2 or 3 kisses instead of to dey take monthly rent. 4. Aboki Rabiu wey dey sell meat no dey take kisses so I dey give am alternative pleasures, I hope say you understand. Kiss 5. Miscellaneous expenses, 40 kisses. Please no worry about me oo I still get balance of 35 kisses and I go take am survive dis new month using this balance… Shall I plan the same for the next month..??? Your Sweetie.pie Sulia Guest wetin Akpos go come Reply...............................................................
Posted on: Wed, 24 Jul 2013 09:06:05 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015