Are you murmuring, grumbling or complaining? Are u saying u neva - TopicsExpress



          

Are you murmuring, grumbling or complaining? Are u saying u neva get wetin u dey pray for; saying u neva accomplish ur dream. Do u tink dat to see anoda day na moinmoin? U think say sleeping & waking up na small thing? Or u think say going out & coming home safe dey easy? Can u count d number of people wey don die from January till date? Abi u fit count d numba of people wey don die or get into serious wahala btw last 9t & dis present hour? U don’t even know the number of people wey don die due to road accident this week alone. U dey complain dat u no get husband, u no get wife, u no get children, u neva build house, u neva buy car or ur biz no grow. U dey always complain dat 9ja no good but u dey use BB, iPad, Samsung Galaxy, smartphones, Laptop etc. GOD woke u up ds morning & u neva run mad. Abi u don see person wey dey coma on hospital bed answer phone calls? Blind man dey change DP or post pix on facebook? Se u don see dead body wey comment on facebook status? Book Haram neva reach ur side, road or domestic accident neva kill u, plane crash neva happen, kidnappers neva kidnap u, 9ja police neva shoot u, armed robbers neva kill u & u still neva appreciate GOD. Hmmmmm; I PITY U! But for me & my wife, WE WILL ALWAYS APPRECIATE & THANK HIM FOR HIS MERCY.
Posted on: Sat, 16 Nov 2013 13:46:38 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015