Barca don dey gap all man again Barcelona troway all de gbege - TopicsExpress



          

Barca don dey gap all man again Barcelona troway all de gbege wey dem get since las week, afta dia forma presido, Sandro Rosell waka comot, put for one side, to waya Malaga 3-kondo on Sunday, come gap all man reach top of Spain League. As dia new presido, Josep Maria Bartomeu dey look match for stadium, Gerard Pique score Barca fes goal, as fes haf remain five minit to finish, afta Xavi nasa one beta corner enta 18. Second jus reach 10 minit, bifor Pedro colet one helele pass from Messi, turn sharp, sharp, come faya ball enta net to make am 2-kondo. As Malaga still dey try get diasef, Pedro jus nasa one beta cross wey Alexis Sanchez sama enta net, to make scores 3-kondo. Na goal numba 12 for Sanchez dis season. Upon all de goal wey Barca score, Messi sha, no fit score hin own. E mean say de guyman neva score any goal for Spain League, for eight strait match. Atletico Madrid dey bracket Barcelona ontop league table wit 54 point, afta dem waya Rayo Vallecano 4-2 on Sunday sef. Real Madrid dey shadow dem for back wit 53 point. As Barca match start, na Sanchez for fes score sha, afta Cesc Fabregas troway one helele pass give am. Sanchez try Hite Malaga goalie, Willy Caballero but de ball nack post comot! Malaga come try show diasef as Duda nack one sweet free-kick for de oda side, but Barca goalie, Victor Valdes save am. Barca jus attak sharp, sharp and na so ball reach Messi. Hinsef try hite Caballero onli say ball no gree enta net All man bin sabi say Barca go score sha, and na Pique cone score hin second goal for two strait match so. Malaga goalie, Caballero, come work like jackie, as de guyman no gree Sanchez and Fabregas score wen second haf start, and Pique sef, nod anoda corner wey Xavi send come, nack bar. Na Pedro come show Barca road, as he colet Messi pass, come bend de ball enta net. Na Messi sef, start de third goal, as de small winch colet ball, tia race, come pass give Pedro. Pedro jus lay am for Sanchez and dat one jus nack am enta net. Atletico sef, jus dey bracket Barcelona afta dem balance, bilala Rayo Vallecano. Rayo dey hear wen for league dis season sha. David Villa fes start de gbege for Rayo, afta hin faya ball enta net as match reach eight minit. Na goal numba 11 for Villa be dat. Rayo come see penarity immediately. Jonathan Viera jus waka, hamma de pena. Atletico goalie, Thibaut Courtois say for wia?! catch de pena. Arda Turan come score Atletico second goal, afta Diego Costa and Jose Sosa tap ball like winch, bifor Viera come hamma one enta, for Rayo Vallecano. E be like say de ball nack Atletico defenda, enta net sef, but de tin come give Rayo small hope. As fes haf wan finish, Atletico come colet free-kick wey Gabi nasa enta 18. Turan jus faya am enta net to make scores 3-1. Like say tins neva worwor for Rayo, dia playa, Saul Niguez come score inside hin own net, as Diego Costa dey mark am, bifor Joaquin Larrivey come nod ball enta Atletico net to make match finish 4-2. As Atletico numba one goal scorer, Diego Costa no fit see goal for de las seven match so, David Villa come kukuma dey score now, and na wit yanga he score Atletico fes goal sef, afta Costa lay ball for am. De tin sweet David Villa sef. E sweet me say I helep my team win dis match so, come score sef, na im Villa tok. E good say we dey win match so, espeshally wen we dey play away. Meanwilly, Athletic Bilbao don set for fourth position afta dem waya Osasuna 5-1. Na five point Bilbao dey carri gap Villarreal for fifth position.
Posted on: Tue, 28 Jan 2014 11:26:40 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015