DEAR LORD;;; See those my fren wey de smile? Abeg increas dia - TopicsExpress



          

DEAR LORD;;; See those my fren wey de smile? Abeg increas dia smile as many times as u can... U see dos ones wey never laf at all 2day? Na on my knees I de take beg u, go dis night n giv dem wetin go mak dem smile 2moro mornin.... DADDY!!! U see dos ones wey de cry? Abeg jus go dia, help clean dos dia tears com carry ur own special smile use am design dia face.... For dos ones wey things don 2 hard 4 dem, put ur hand n mak things easier 4 dem... God, see my brothers dem n my sisters, abeg mak dem flooooourish lik palm tree o.. For my mummy, carry ur special blessing use am design her life 4 me, carry d distans of d sea use am increas her life too o.... Myself nkoh? I no won sleep alone dis nit o, I won sleep lik a baby, send ur angels mak dem com nurture me, mak I wak up 2moro mornin 2 see dem serv me with differen freebies. All dis ones na ur main pikin name; jesus na him I take beg u o. AMEN.
Posted on: Sat, 06 Jul 2013 21:52:44 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015