E get one restaurant wey i dey chop for Ojuelegba. One oyibo dey - TopicsExpress



          

E get one restaurant wey i dey chop for Ojuelegba. One oyibo dey always come chop there too. Any time dis oyibo chop finish, him go shout “heey!”, so i wonder wetin dey make am shout. I decide to chop wetin the oyibo dey always chop, so maybe me self go shout too. When i reach d restaurant last week friday, I order wetin the man dey chop, dem tell me say na chicken and red wine, so i chop am. I surprise say i no shout, i even collect extra plate, but i still no shout. Na then i just vex ask for my bill. The waiter tell me say one plate of chicken and red wine na N45,000, and the extra plate na another N45,000. Na then i come shout heyyyyyyyyy! heyyyyyyyyy!! heyyyyyyyy!!! heiiiiiiiiiii!!!!… till i reach house i still dey shout.. HAHA
Posted on: Tue, 30 Jul 2013 11:16:08 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015