EASTER JOKE 1. Papa Ogaga say life too hard so he want kill - TopicsExpress



          

EASTER JOKE 1. Papa Ogaga say life too hard so he want kill himself naim he tie rope for throat on top ebelebor tree. As he want comot the chair wey he stand put, naim Ogaga run go meet am Ogaga: Papa wetin you dey want to do so? You want to kpoof yourself? Papa Ogaga: Yes na. When man born rubbish pikins, why he no go kill himself? I want die. Make I die at once before hungry kill me small small Ogaga: Papa, no shaking. Carry go. Fire down. You know say u say make I no dey play jomgba (gamble) but I play last week and I win 100 million naira. So papa just die. Your burial ehhh, people go fear. I go use money scatter the place. To die go hungryall your friends Papa Ogaga: You say wetin???? Hundred kini? Ogaga: Shoo papa, bone!!! I say die quick make I use the opportunity show people say I done arrive . Papa Ogaga. OGHWEFIA! Die wetin???? Oya shebi na Easter? come help me lose the rope make we go celebrate my resurrection. (adapted)
Posted on: Thu, 17 Apr 2014 21:30:28 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015