England strika, Wayne Rooney don dey draw rain for Manchester - TopicsExpress



          

England strika, Wayne Rooney don dey draw rain for Manchester United oga dem, afta tori start to waka say hin go be Robin Van Persie ‘boy-boy’ for de new season wey wan start so, na im some amebo pipu dey tok. Television pipu, Sky Sports, bin yarn on Tuesday, say some of dia amebo inside Manchester United tok say Rooney “dey voke and de tin dey pain hin belle well, well” as hin hear say na club coachi, David Moyes, start de tori. Even tho David Moyes bin don yarn bifor say dem no go sell Rooney (na David Moyes fes give Rooney chance to play beta ball wen dem still dey Everton), but hin come yarn, on Monday, say Rooney go dey siddon for bench for Van Persie, instead of make de two of dem dey play togeda. ”De way me dey look Rooney so, if Van Persie wound, na dat time we go look Rooney side,” na im Moyes tok, as United dey waka for Asia and Australia, as dem dey prepia for new season. Moyes still tok say: “I for like dey play de two of dem sef, and I go like use Danny Welbeck and Javier Hernandez (Chicarito) join. I go like make we chance plenti well, well.” Van Persie bin score 30 goal for de season wey jus pass so, and na hin bin carri prize for strika wey scoregoal pass for England, but na onli 12 goal Rooney bin score. Rooney waka bin dey one kin las season, sotay United coachi dat time, Alex Ferguson, no gree put am for some kin ogbonge match, plus dat second round match wey United follow Real Madrid play. Rooney don helep United win Premier League five tines, Champions League once (for 2008) and two FA Cup. Hin bin carri Players’ Player of the Year (na prize wey all footballer dey give de bes playa) for 2010, aftahe bin don carri Young Player of the Year (na prize for playa wey still be small pikin even if hin dey tap for league) for 2005 and 2006. Rooney don score 36 goal for England, for de 83 tines wey hin don play for National team.
Posted on: Wed, 17 Jul 2013 10:13:10 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015