I just want to show una how fellow Muslim parents wey their girl - TopicsExpress



          

I just want to show una how fellow Muslim parents wey their girl pikin dey lost dey act. I want make una see how dem hold the girl picture an how them dey beg kidnappers and police. 234 abi 176, not one video by Channels or Silverbird or NTA or AIT of papa and mama wey dey cry blood say pikin wey done reach 18 years, wey kpekus pain im mama wey dem born her and waist pain papa night wey he conceive her....no one done cry make we see. If that village organize mass marriage, make we know. cos the behaviour of parents and the media for this matter dey let me dey scratch head. Ehen! My Urhobo people, if them thief all the girls for Ibada-Amukpe, Ogwe eya no go open breast tear wrapper swear for the matter? Them go quiet for 3 weeks? youtube/watch?v=D1l-740dmmw
Posted on: Sat, 03 May 2014 20:15:29 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015