I miss Photostand thats where poly chics have their RED CARPET, - TopicsExpress



          

I miss Photostand thats where poly chics have their RED CARPET, showcasing Aba and Ok dress,lol. I miss Guiness spot where everybody de fear if the next man na fraternity man lolz. I miss ceremonial ground, where we go de read 4 night class students go shoot gun and other students go leave their books wey them get the next day, jump window and next 2min hall wey full go empty.. lolz Miss those GingeRin from Engineering students. I miss that okirika man wey de beside sharon, where babes buy bend down select de form, ... my aunty sent it from jand for me #shakng my head# I miss Umuerim @ night where u eat roasted fish, plaintain, akara..Etc. I miss Johnceilia, oboy! Where guys go carry their chicks come chop cheap but good food I miss poly shrine wey dey Umuerim wey you go de come back from school you no go see road pass because them de road! I miss axe men and baggers fight, lie lie people, 10-0, 20-2, yet we no go even see blood for ground talk more of 1 deadbody, na 4 sky una de kill them? lolz I miss STATE people, wey de always carry charger waka up ann down inside school. I miss south africa, where if you de pass you go don comot your sim card from your phone, put am for socks,hold the phone for hand. I mis uzo- mmiri where guys and thier chicks cannot come out at night wether nepa de or not.I miss 1000 capacity hall where if we de write exam we de sit 2 per desk and no turning of neck (Reserve my comment). I remember pop corn stand, wey if you come late, you go use ur hand hold waterproof,make them serve you popcorn. Kiaaa!, i no 4get ishage ri i gwa (big fufu and 2 big meat, choi!!). I miss fidelity and Access ATM where guys go de queue de check chicks wey fine and get shape and the ones wey no fine..and Ill not also 4get hostel A where chicks de hang 4 hostels balcony dey check guys wey enta with latest car and well loaded... I miss school road 4 winter suite where guys and some chicks de come club, guys go pass chicks... if i continue i no go finish! Make i end am here jooor........i miss fedponek like maddddd joooorrr! ..... Continue the fun if you represent federal polytechnic nekede...
Posted on: Wed, 30 Oct 2013 06:05:31 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015