If animals and insects were on Facebook, we’ll be having posts - TopicsExpress



          

If animals and insects were on Facebook, we’ll be having posts and comments like: 1. MOSQUITO’S WALL POST:Finally PHCN don off light, blood sucking things. COMMENTS: a. Shyiet, dem don on gen for my end. b. Abeg bros which area you dey? My people don fleet house. 2. DOG’S WALL POST: Na wa oh, I never even stay reach 5mins, all these Calabar people don dey eye me. *Ghost mode activated, them no go see me* escaping things on my mind. COMMENTS: - My neighbour na calabar too. The man eyes no good for where dogs dey, I go soon bite am. - Lol, guy, you dey on your own oh. 3. RAT’S WALL POST: Omo na die I dey oh. No food for my master kitchen. Na ehm books go hear am nah. Ehn think say I come dis house to watch tv abi? COMMENTS: - Your master stingy, disown am jor. - Guy, if I be you, na dat wicked master certificates I go chop sef. 4. CHICKEN’S WALL POST: On the 1st of December, I’ll be traveling for one month, if you need my attention, abeg just enter bush, I no fit shout. All these Christmas celebrants no be am at all. COMMENTS: - No be only you oh, I dey migrate too. - My brother, your head dey dia, call me wen you dey go. 5. HE-GOAT’S WALL POST: Heat mood activated, any she-goat online for se’x chat? COMMENTS: - She-goat. @He-goat you’re a capital BIG fool. - He-goat. @She-goat, pretender does the worst, carry your smelling sef comot for my post jor. Agree or disagree?
Posted on: Sun, 07 Dec 2014 10:23:13 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015