Joke: Akpan In The Examination Hall! During the last - TopicsExpress



          

Joke: Akpan In The Examination Hall! During the last WAEC examination, Akpan a typical Warri boi was asked complete some proverbs, check out his answers to the questions: .1)He who fights n run away? Akpan: e don surrender be dat na, na fear catch am. 2)A rolling stone? Akpan: No fit just dey roll, na person push am. 3) He who lives in a glass house? Akpan: Na rich politician e go be. 4)A stitch in time? Akpan: dey prevent further tear tear. 5) Birds of d same feather? Akpan: Na d same mama born them. 6) One good turn? Akpan: Na correct power steering fit do am. 7) A bird in hand? Akpan: Wetin e wan be again if nobe barbeque. Dem plenty for chicken republic. Half bread is better than? Akpan: Puff puff, buns or garri without sugar. 9) A journey of a thousand miles? Akpan: Na d person wahala be dat na, Why e no enter car or aeroplane jeje? 10) He who laughs last? Akpan: Get brain problem. Make dem examine am becos na begining of madness be dat. 11) A patient dog? Akpan: Na hunger go kill am. 12) All work and no play? Akpan: Na bank job be dat bros. 13) Once beaten? Akpan: Na revenge go follow b dat. 14) A fool at forty? Akpan: U never see Naija own, ours starts @ 50. 15) A friend in need? Akpan: Na parasite b dat. Will akpan pass the exam ?
Posted on: Wed, 14 Aug 2013 00:54:47 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015