Luke 4:1-5 Di Holi Spirit enta Jisos bodi kon kari am from Jordan - TopicsExpress



          

Luke 4:1-5 Di Holi Spirit enta Jisos bodi kon kari am from Jordan Riva go insaid widanes. For der, devol kon tempt am for forti days. Dat taim, Jisos dey fast, so e nor chop fud, bot afta e fast finish, e kon dey hungri. Devol kon tel am, If na tru sey yu bi God Pikin, mak yu komand dis stone mak e turn to fud. Den Jisos ansa, God wod sey, Nor bi onli fud man sopoz to chop for dis wold, bot na evri wod wey God tok. Den devol tak Jisos go on-top won mountin kon show am all di kindom wey dey dis wold.
Posted on: Thu, 14 Nov 2013 07:01:21 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015