MONDAY NEWS 1ST DECEMBER 2014 AUCHI POLY TAFIA WEEKEND - TopicsExpress



          

MONDAY NEWS 1ST DECEMBER 2014 AUCHI POLY TAFIA WEEKEND NEWS: UNA GOOD AFTERNOON OOOO.. HAPPY NEW MONTH Lecture Continues Today, abeg make all the NEW student try resume bcos wey nor go Hold any Lecturer faulty if he Set Test Report Use Mouthpist enter My hear say dem go release all SPAT NDF and HNDF today and Tomorrow Report enta Our Studio dis Morning say this Cult student don Resume work as dem nearly Clash for Bawak area Yesterday, I take my Two Kneel beg Una, Make Una Allow Us rest...... Na Yesterday we enta School qo do Amebo with Innocent pple, we cum hear say MADAM PATIENT EBELE JONATHAN go enta Auchi Poly for the 50years anniversary,, #CHAI, THERE IS GOD OOO,,, #Welcome #Mama .... For those Of Una wey wan do Clearance or Pay School Fees Next Year, Una fit do am, make Una Chill, Auchi nor be wetin dem dey Rush.. Convocation na dis December, we neva confirm d date Yet by Oursef but rumors say na 13th e go b.... Report take Parachute jump enta our studio say Spat for dey expire Dec., 16th and Exam na Jan. 6th, abeg make Una quick rush am bcos our Reporters wey be Bankers dia dey yarn Us say d form don nearly finish and We don Confirm am Say na CBT. Lectures dey Continue for all Dept toDAY and all timetable don fall Out ooo... HND Third batch dey Load wella, e go Show Face soon, anybody we qet Leg make e Use am wella ooo,, #Mouth_Sealed..... SCHOOL FEES SUMMARY FOR 2014/2015 REGULAR SESSION ! *ND1 and HND1 sch fees » 28,000 bank commission 500 Fidelity Bank *ND2 and HND11 Sch fees» 14,200 we don Confirm am say na CBT dem go Use for SPAT EXAM ooo While rumour get am say na only screening dem no go do....... NOTICE Abeg TAFIA nor be Human Beinq ooo, na Ghost so anybody wey tink say e easy to See me, abeg make d Person WORK WELLA bcos dem don take Girl Trap am tire but Who tell Una say he Neva Marry??...... ABEG THE LIST OF THIS LECTURERS na People wey I want Make Rector Sack or I go Pursue dem Myself. * (Name Witheld) * (Name Witheld) * (Name Witheld) * (Name Witheld) We qo Post dia Names 2maro ##B.TECH (DEGREE PROGRAMME) Admission List go Soon show Face #HOSTEL don dey get pple wella as we see Student Yesterday just dey Cook like say na Christmas,, Una go Soon go House qo reload If Una nor take kia..... Tuale to my Oga at the top... Mama Rector, i hail Ma My HOD, i salute u sir Hon Speaker Emma (SUG) Hon Justice Samuel Prec(SUG) Sen. Abada Lucky(SUG) Advocate Eric Ulala(SUG) Comr. Ilunuamie Gentle(NAOSAP P) Comr. Jayeola David(QS PRESIDENT) Comr. Osaretin Maxwell(Env. Fin Sec) And others bcz dem many wella... Before people begin to circulate Pirated, Cheap & Unauthorised NEW MONTH greetings to u, I wish you and your entire family the original HAPPY NEW MONTH with NAFDAC registration number:. 01-12-2014!.. What troubles YOU in NOVEMBER will bring breakthrough for YOU all this DECEMBER. Happy NEW MONTH..... This na wia we go take End Our Ogbonge News.... AUCHI EDO STATE GO BETA Na me be * D OTARU of AUCHI POLY * D PASTOR OF AUCHI POLY * D AMEBO OF AUCHI POLY * D MOUTH PIST OF AUCHI POLY * D EAGLE EYE OF AUCHI POLY * D CHIEF INFORMANT OF AUCHI POLY * D NETWORK OF AUCHI POLY AUCHI
Posted on: Mon, 01 Dec 2014 11:35:38 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015