.. NUEE Strike don dey suspended.. De South East chapter of de - TopicsExpress



          

.. NUEE Strike don dey suspended.. De South East chapter of de National Union of Electricity Employees (NUEE) don suspend dem long term strike wey give epilepsy to commercial activities for de zone. Mr Cyprian Akor wey be de Assistant Secretary-General of de union, talk am wen him follow de News Agency of Naija (NAN) for Enugu. Ihn yan say de union don suspend de strike because of de positive agreement wey dem reach between the management of the PHCN and the union. "We don temporarily suspend de action but if dey relent for de agreement wey we reach, we go go back to begin de strike again. But for now we go do everythin we fit do to cover up de services wey we no take render during the strike,” Strike, strike, strike everywere for Naija.. Asup don suspend dem own, FG neva answer dem ASUU.. .. Na wa ooº°˚˚°ºoo .. Seh na like dis we go dey dey?..
Posted on: Mon, 22 Jul 2013 20:16:39 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015