Na only 4 naija you fit win Aeroplane by loading N200 MTN card! - TopicsExpress



          

Na only 4 naija you fit win Aeroplane by loading N200 MTN card! Very soon Etisalat go say recharge N200 & win a big ship! Then Airtel go come follow say, recharge N100 and win Benin Republic. GLO go just kuku say recharge N500 and win Nigeria, bcoz their colour na green! Na only for Nigeria you go see fish inside "MEATPIE." Na only 4 Naija we dey count money after we withdraw am from ATM machines! Na only 4 naija PHCN dey say, win a brand new Generator if you pay your electricity bill. Na only 4 naija people dey horn 4 traffic light make e quick change from red to green. Na only 4 naija pharmacy dey sell coke,recharge card,chin chin,puff puff, ogogoro & beer. Wetin you no fit see 4 anoda country, e dey happen 4 here...Naija, I hail thee.
Posted on: Tue, 08 Oct 2013 19:17:54 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015