Noon News/Updates. Ebedi wey be Jehovah Witness Number 10 - TopicsExpress



          

Noon News/Updates. Ebedi wey be Jehovah Witness Number 10 Footballer for Urhiapele Primary School Jay Jay do Wedding yesterday for Kajola Guest House for Ugbeyiyi axis. Na Rice,Coke and Fanta nai dem share give Mariam Jasper and Tafia Elengoro. Vera wen dey use Jazz dey doke anoda person nor dey bold go her store again,as na only Night she dey sew now,and she dey gap mouth say na she go expose Sapele Tafia. Vera dis warning na ur last warning,leave anoda woman wen helep u husband or else na problem u wan sign wit me and ur generation. Wicked Witch. Sapele Tafia Crew don repent from Igbe today. We don declare to worship Baba God all the days of our Lives. God touch Okpubuluku, Okpukpuru, Mariam Jasper and Oturugbeke hearts today for Winners Chapel Branch wen dey Ugbeyiyi. All of us kneel down, raise our white handky up as we pray make God restore Sapele and save us from the hands of bad leaders. We still pray for everybody wen dey dis Forum say, death go see unu run as Our Crew don declare one week dry fasting for the head of anybody wen nor want Sapele to progress. As we repent so, e nor give unu yard stick to misbehave. Our gbwa nor follow we repent. We still dey gbwalize any gbwalism We dey use dis medium dey inform all well meaning Bishops, Rev Fathers, Pastors, Evang and d entire Christian Association Of Nigeria (CAN) to pray against untimely deaths for all SAPELE YOUTHS. I don dream see many casket wen contain deady body again. Dem line dem for Olympia, as I open dem, all of dem na so, so youths. Na d name of Jesus I shout take wake up. Na beg we dey. Nor be only prosperity we go dey preach about, All Churches wen dey Sapcity, make unu join hands to pray for Sapele b4 d end of dis month. The HSC training course still involve girls. Report don land for our studio say Girls go fit still learn d course. Mama Ojiyowvi wen born Ochuko, wen dey stay Jakpor Road after dem Dani Kay Papa compound, u don use ur two Girls children take wage kola nut tire for Married men for dat Ogorode axis as u get d believe say na married men dey pay pass. What goes around, comes around. Go beg ur junior Sister wen dat ur rude daughter (Ojiyowvi) go slap becos of man, if not, u go pack go village by d time I finish with u. With ur face wen dey smell (^). Ugberikoko/ Gana Axis runs girls, especially Treasure Edojomi, Elohor Osegwa, Alero Buwa, Ufuoma Isodje, Ufuoma Ofogba, Odiri Ogodi, Prick go soon burst out from unu troat as unu nor wan use unu time well so. Dem nor dey live life dey go back. Make unu stop to dey do runs, so dat My God go fit write unu names for THE BOOK OF LIFE. Ashawo nor dey pay. Ashawo die, kponyor go rest. One yeye nurse wen nor dey put eye for work. Her name na Nurse Hope, e dey do auxiliary Nurse for Jesus Heal Clinic. This yeye girl dey under suspension since as e nor fit dey put eye for d job. Report fly enter our studio say, d Doctor in charge of the Clinic, don forgive d nurse as e nack her with heavy purnishment. Nurse Hope, try use ur sense. As u dey learn work so, e good but put ur eye down. Nor dey think about prick. If u misbehave again, na injection wen go turn ur breast to slippers, nai I go give u. Yeye dey smell follow u. Lesbians dem don start for d town again. I dey compile unu list. Na d senior broda of gbwa wen dem dey call Ukeh-gbwa nai I go release for unu body soon. Eye wen dey cry still dey see road. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Sun, 03 Nov 2013 12:02:57 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015