P.M NEWS/UPDATES. 09/05/2014. Report use Okosisi white hilux - TopicsExpress



          

P.M NEWS/UPDATES. 09/05/2014. Report use Okosisi white hilux take enter studio say One Aboki truck just run divert from Hausa Road use speed go damage the gutter and tarred road wey dey Itsekiri Rd by Hausa Rd and d Trailer carry heavy load. As we dey talk so some group of youths wey dey claim Local Govt Council workers don dey disturb the driver to pay for d damage. Report use DJ One Million Od Speaker take enter our Studio say Mr and Mrs Prince Miller Rowuno ( Chairman Loaders Association for Water side) wen marry him wife for over 13th years without pikin, d man come go outside go marry another woman and she cum give birth to two children. Today d one wey d man family and people dey call barren woman cum give birth to a bouncing baby Boy. Our studio say Congratulations Madam and make u do shakara becos all ur enemies go shame and dis pikin done open d way for other better ones to cum. Report enter studio say Late Sunny Ishola Adeyemi burial get better crowd as almost half of Winners Chapel members, Redeem church 24% of deir members and few Aladura members nai come d venue. PMAN Members still dey d ground and the Comedian Guild members still go pay their last respect. I see Uyi motors and Brother Tuemi Mene but people plenty sha and nor be small treking we trek go d burial ground. I vex for d sound engineer today as d microphone just dey do ON and OFF for a whole Sunny Funeral. Report reach us say Tima Guest House don dey beat DE ROSCA for Ashawo package due to the high level of different Girls Army pipo dey use dey nack ground. One fair girl wey dey Ugbeyiyi Rd don turn regular customer and she get serious guy wey don give her engagement ring. I just nor wan call her name yet make i nor go spoil future marriage. You know ursef so adjust becos i go announce am next time. We dey draw the attention of Hon. Julius Egbedi to d way dirty don dey cover part of d New Rd Express way opposite Efe Mafuru Linkers Guest Houx. He nor good make we dey keep dirty like dat for Express way like dat wey lead to many companies for dis town. Dat one go dey send wrong signals to our visitors say we be dirty pipo for dis town. Report reach our studio say NEPA STAFF SCHOOL, OGORODE, their school fees don go up as e be say dem don slash their workers salary by 80%. Wen we interview some of dem, dem say d new investors nor ready to carry d school join their expenses as dem nor get time for d school again and dat one fit bring d school to close kpatakpata nai make dem wan increase d school fees by 60% so dat dem fit foot their teachers salary by demselves. Na wa. Regina wey be street ashawo for Edahirere Road. With ur village and native face. Ur gbwa don dey ring AT&P alarm for our studio. If u nor learn how to dey close dat ur imie-sa kponyor for dis town, HIV go use u take do pipi-oghelewa. Report use shinny nose fish take enta our studio say Ufuoma Mixed Secondary School don turn depot of Ashawo as d girls students dem dey sleek out of d school during school hours dey go doke as dem dey jump dey enta different cars including okadas dey go run tinz. My CCTV Camera don dey collect all of unu names for public disgrace. Nonsense yeye girls. GOD BLESS SAPELE SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Fri, 09 May 2014 20:14:12 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015