P.M News/Updates. 27/4/14 The Olu of Warri, Ogiame - TopicsExpress



          

P.M News/Updates. 27/4/14 The Olu of Warri, Ogiame Atuwatse 11, don call on Itsekiri sons and daughters especially those wen dey abroad say make dem join forces and work towards the growth and development of the Itsekiri nation. The Commissioner for Transport Hon. Ben Igbakpa don talk say he nor go relent to bring sanity to the roads, as he yarn say drivers wen refuse to obey traffic laws, dem go continue to dey impound vehicles as he talk say if orderliness dey the road, dat one go bring free flow of vehicle movement. Report enter studio today say Sunday Ogba wife wen born twins 4 am wen her Mother get store for Ogodo Road by Macpherson go shop rice for Ikomi Road. The food cum over sweet her nai she forget her Iphone 4x. She dey dere now dey look for d phone. Also one Engr Eddy Isabu wey dey attend Catholic Church for Yoruba Road also lost e phone today for deir church. If unu get any means to refund dis two phones make unu visit our inbox. We go hide unu names wella. Report just blow come now say majority of the smallies wey dey Richard Continental Hotel right now nor dey buy anything as dem just dey waka dey find Girls and who go buy free drinks for dem. Julius and Akpos wey dey stay Green Egbedi don dey turn nuisance for T.M. The sales Reps for T.M dey very smart dis evening as one slim Girl catch one guy wey almost run after e don drink finish. Dubre family make unu warn unu selves oh becos one of unu Broda don don public liability as e dey swellop face dey rag beer. Report from Make Peace beer parlour wey dey Ajogodo Rd be say the place lack patronage from usual Amukpe and Okurighwre boys becos dem don tire to dey hear so so Igbo musics. The owner don dey fall e hand becos na only Igbo guys e dey give attentions to. We dey use dis update dey call on Emeka and Uche wey dey sell Rods after Zenith Bank to reduce deir everyday beer turning point becos as i dey see am so, na deir business capital dem dey wak so. Report tie scarf enter our studio say dem stage one freedom party for Otubu pikin store for New Rd by Andoma. Na so d girl wen dem dey do freedom for face strong like Zuma Rock. The DJ finish work but na so, so native pipo nai dey d ground. Na so babes wen gada yanch just dey parabulate d ground as one wen draw tatto for her entire yanch just dey shake d dirty wen she carry for yanch without shame. Report wear Cele Lace enter our studio say Erisco Catering wen Egbejule wife get for Abeke Rd opposite Abeke Primary School do Freedom for 3 of her girls. Na so drinks dey go on for d venue but d parade wen different girls wen wear short skirts take enter d ground I nor too like am. Na so Progress wen fine past among d 3 girls but she get che-che-re-che body just dey do too know just becos say one of d girls get strect mark for breast and she con dey bleach join. I clap 6 plates of rice join d one wen dem give me say make I hold for d guy wen sit down near me. Na so Carol Egbejule just dey do eye kaba-kaba dey find me for d ground. U get luck say d pepper wen I wan sight for ur eyes sour b4 I reach where u dey. Report jump with two legs enter our studio today say na one of Otubu grand pikin nai do introduction today with one of Eyube pikin wen do mouth like V-booth. Drinks surplus but d rice get sour taste. Na so all dem Amaka and her crew of fake yanch girls just dey terrorize some guys gbogi as dem don dey recruit small girls dey join their crew. D entire Gana finish for d introduction. Report come from one pussy cat wey dey Urhiapele Primary School say dem do one marriage for dere today and the ground just dey o.k but na meetings group nai full the canopies as the Bride senior sister nor even fit invite her meeting group and she pay fine becos na today the meeting group dey hold deir meeting for deir usual location. The couples dance well well and food go round well but the drinks nor too go round. God Bless Sapele SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Sun, 27 Apr 2014 20:17:48 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015