P.m News/Updates. 28/10/2014. Report enter studio Hon. - TopicsExpress



          

P.m News/Updates. 28/10/2014. Report enter studio Hon. Ejaife Omizu Odebala swear in him Councillors from all the WARDS wey make up Sapele Local Government Council for state level. The swearing in take place for Sapele Local Govt Sectetariat today by 3:30p.m and during the swearing in all PDP stakeholders for Sapele and all the Council NULGE Exco and Newly elected council councellors dey d ground. Then first meeting within the Local Govt Council Chairman and him cabinet hold today via Indoor. Even if fear nor let us announce the actual result of the just concluded Local Government Election l,most especially for Sapele,so that make NIGERIA BROADCASTING COMMISSION (NBC) wey deir Office dey Reclamation nor cum shut dis studio down,as dem shut J F.M down eternally. Dis na the assured result from WARD3 wey dis studio take announce UKERE as the winner. Dis na the results from allthe units in ward three sapele local govt,unit1; Sdp 0,labour 3,Pdp 21,Apc 25. unit2;Sdp 2,labour 5,Pdp 27,Apc 26. unit 3; Snacthbut was brought back to deic office with ballotpapers and result sheet and the security and officials accept am. VERY WRONG. unit 4; The same thinghappened. unit 5; Sdp 1,labour 4,Pdp 48, Apc 28. unit 6;snacth. unit 7;Sdp 0,labour 1,Pdp45, Apc 34. unit 8; Sdp 1,labour 1,Pdp 17,Apc39. unit 9;Sdp 0,labour 1,Pdp 22,Apc 73. unit10;sdp 0,labour 9,Pdp 20,Apc 34. unit 11;sdp0,labour 8,Pdp 35,Apc 13. TOTAL RESULT: SDP4. LABOUR 32. PDP 235. APC 272. I announce UKERE the rightful winner and i order am to go Court and collect him Victory or sue DSIEC. Report enter studio say ETHIOPE WEST Local Government Chairman Hon. Solomon Golley don swear in him Councellors yesterday immediately e return from the State Swearing in from Asaba yesterday. During the swearing in he charge all the Councellors to work hard to effect change for the lives of the people wey dem dey serve. One of the Councellor throway appreciation and promise to work hard to redeem the Party image for the Locality. I don dey over dey quiet over the manner wey BEDC dey treat the people wey dey Ugberikoko Area for near Rex Hotel becos dis people don dey for over 5Months now,no Transformer, and dem never see light. Dem don meet BEDC but dem dey talk say some people dey owe bill and not until dem pay dem nor go bring Transformer come. Dem also talk say Oga Rex dey owe N200,000 and dat upstairs wen dey near d Transformer dey owe half a Million. I just dey laugh becos dis na where BEDC wan pass fall deir hand bcos dem wan use other people sins take punish poor masses against their own rules. And na still their fault bcos dem dey go cut light and once dem give dem small money dem go live d debtors waka pass. Report enter studio say d Transformer wey dey Shell Road opposite Mechanic Village get fault since 2weeks now. D painful part of am be say, Bedc nor even shake body to go check d way 4ward! Na d Transformer nai Winners Church dey use! Winners Church wey dey Shell Road make unu try upgrade to atleast buy and donate one 500kva Transformer to the area to improve the lighten system for d area so that unu go fit get one line as unu own wey go dey supply constant light to unu Church buildings. Report reach us say world woman spinner and woman looker, black Patrick Jeroma wey do face like boa wey rain beat don start he bad attitude again as he don dey do fixed deposit with he eyes for girls body. Jeroma, nor go count money miss one day becos of ur LOOKAMANIC Character. You nid deliverance for mercy land church. Report jump wit hot water enta awa studio say make we troway hot warning wey dey boil give dat girl wey dey sell fruit for Oleh Rd opposite dat compound wey near Nene Hospital just afta Igbuya in-law compoud. Dat girl dey always dey open her ova bleached and coke wey mix with fanta belle for public. So, so shirt nai she dey raise up make men eyes for dey enta her body. Naso d opio don enta ur eye reach? With ur dirty yellow and slippers breast. Try shame small becos me dey helep u dey shame. Report fly with Obledi cutlass enta studio say All Pool Agents tanda today do their monthly meeting for Fabulous Charlet wey dey Cementary Road by Itsekiri Rd. Naso dem pack full d chin-chin hotel like sardine. Dem even use their bikes take block road as d congestion con make road users find am hard to ply dat route. Next time wey unu go block road like dat again, na Ben Igbakpa i go call to come clear unu bikes. Report jam our studio inbox from BEDC official say d transformer wey dey New Rd by Obire Junction short oil and as such, d affected areas go suffer lite small until BEDC go fit put d compatable oil wey d transformer dey use. The BEDC official say make we appeal to all of unu to exercise small patience with dem. D BEDC official still vex say dat Company wey dey opposite Obire Junction, their big, big cranes and caterpillar dey jam d wire wey cross their front and such tin dey cut d wire and wen e cut d wire, d sparkment go return back to d transformer, d tin go con trip off everytin at d detriment of transformer. Make unu team up go warn d company bifor unu transformer go enta R.I.P state and make unu stop to dey disturb my inbox until unu go warn d company. Report enta studio say d ogbegbunu pipo wey dey predict eclipse wey dem dey call NASA, dem don confirms say Earth go experience 6 Days of total darkness by December 2014 for d whole world. NASA nai confirm am say the Earth go experience 6 days of almost complete darkness and e go happen from on Tuesday the 16th to Monday the 22nd of December. The world go remain, during the three days, without sunlight due to solar storm, wey go cause dust and space debris. Dis dust go plenty well, well and e go block 90% of sunlight. Na d head of NASA Charles Bolden nai make the announcement as he ask everyone to remain calm. Dis partial okuku go be the product of solar storm, the largest wey go happen for d last 250 years for a period of 216 hours in total. Despite the six days of darkness, officials don yarn say the earth nor go experience any major problems, becos six days of darkness nor go dey near enuff to cos major damage to anytin. Oya BEDC make unu ready becos we nor wan hear weytin Uhrobo pipo dey call Aso mosho, okuku roma ba which means Nite dey fear person, darkness con join am. Unu wey nor get beta HEAD-LAMP for unu motor and keke, make unu go put beta one b4 dat period. Hon. Austine Ayemidejor just begin caution him Boys wey succeed the Position as Councellors within the wards wey PDP share reach am to dey over see. Na so e put drinks for ground and begin advice them to emulate him kind of good Government,wey lead to robbery without Life for e yard. God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Tue, 28 Oct 2014 20:10:42 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015