P.m News/Updates. Kate wey be King of Oghara son ex-wife neva - TopicsExpress



          

P.m News/Updates. Kate wey be King of Oghara son ex-wife neva still repent o! Na her itchy kpekus remove her from marriage some years back, yet she nor wan stop her ayangba ways! If unu recollect she get store for Otite Rd dat time and she dey doke dat small Boy wey him name na Bright and na Vulcaniser! As her Husband catch dem two, nai e drive her,she cum run comot for Sapele for some time because of the shame,instead of change she don worse.Na different different small boys she dey carry for her car now, i even hear say she rent house for one guy wey dey School for Otefe and d Boy Girlfriend for Mosogar get am hot with her dis morning say make she leave her guy alone. Abeg if u nor dey shame "Sapele Tafia Crew" dey shame for you. Oyibo Ebosa i don dey over dey see you wit some kind Politicians wey nor get better name for the Town and Delta State,but if u tink say u wan spoil ur senior Broda name,as i don record e name as d BEST LEADER for Sapele,den i bet u say i go personally soil ur name for you INTERNATIONALLY make d World know say u and ur Broda na different pipo. As i dey warn "Richard Continental Reach" reach e nor wan hear word,as small small Children wey norva reach to plate hair just dey pollute d place. See as some Girls dey run shot hand near dat Primary school wey dey d junction of d Road. I dey beg d owner of d Hotel to repair e street light and make e try control e crowd. Andrew wen get Barbing Saloon for Owumi Rd by Anigboro Rd, nor be die u dey so? Your Barbing Saloon don be like 'igbee shrine'. Inside d saloon dey smell like deady body. As u dey work reach, u nor fit use money take renovate ur saloon make e be like Alinco own for Otite Rd. Dirty, ur saloon Dirty. D generator wen u dey use don 'gwor-gwor-kufia'. Na hand dem take dey turn ur fan and ur clipper don turn machine gun and d teeth dey pinch person head. Try make u upgrade b4 I go use Army take come close ur store for gud. I nor know why Pami joint nor dey boom. See as some guys just dey yarn apata for "Ogoro Bar" same "Ibori dey Oghara", "Bando dey Ghana". "Atose dey India dey do Jazz". Infact i run wen i hear gist wey big pass my Head. Na today i know say i dey learn for gist for Sapele. Paul Ovieghara a.k.a Paul Ojolu, atink u nor wan order ur area pipo to go clear d grass wen grow for dat transformer wen dey near UNIK CLINIC? Before unu go wake one day, d transformer go vanish, as unu say na dirty unu wan dirty put so. Dirty pigs. Hon. Goodluck Arimeta, d time wen u dey sukpa, wen u dey use Valentine Barbing Saloon take dey survive, u don forget? Now wen u don become Secretary to Sapele Local Govt Area, u nor fit use ur good ofiz take bring development come ur Area? Oya try make u give Abeke Road By Owumi Road and environs New Transformer. My eye naked for dat ur short body. First Baptist Church wen dey Ogwanja, there today service make brain. Na so d Pastor just dey shout for microphone wen dey 'jikoko' like Timi Ebikagboro. D service bam but d Church fans just dey blow heat. Na so one girl wen dem dey call Jane just dey burst my head with her special number. Sotey I come just open teeth for ground. Many Ghana Burgers go pay Onoriode Amadi condolence visit today for e houx as e be say e pikin die. Instead of unu to dey sober, na noise unu come dey make,maybe unu wan programme d dead pikin body for something. 2ND WARNING! Opepe wen dey marry Amboline wen their houx dey New Rd by Alhaji Houx, stop to dey sell cocain. U don dey pollute dat area and Army go soon come raid u. Yeye fowl wen do face like who dey use condem diesel dey rub. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Sun, 08 Sep 2013 19:00:46 +0000

Trending Topics



/www.topicsexpress.com/Savings-Saturday-Paul-Shagawat-of-Premiere-energy-was-able-to-topic-524637260940877">Savings Saturday! “Paul Shagawat of Premiere energy was able to

Recently Viewed Topics




© 2015