PM NEWS/UPDATES 23/4/2014 Report wear jeans cap enter studio - TopicsExpress



          

PM NEWS/UPDATES 23/4/2014 Report wear jeans cap enter studio say HRM, ORHUE d 1st, Maj Gen. Felix Mujakpero (D Orodje of Okpe) don place embargo on all dos Abokis wen dey carry hoe, cutlass and shovel dey follow everywhere for d town say make nobody dey use dem dey work again for d town due to the BOKO HARAM insurgence wey d Nation dey experience. According to d report, dem say anybody wen dem catch dey use dem dey do job, d person go pay fine. D tin don dey hold ground well, well for Amukpe area of Sapele. Report use Army Uniform take dive enter our studio say Hon. Julius Egbedi escape kidnapping recently. Our studio don put call across to e line to confirm how d incident take happen, but he nor dey gree pick. Report blow fanfanfan enter studio say London Royal Hotel do free Quiz Competition dat on Easter Monday and na 8 schools for Sapele nai partake and na only Okpe Grammer Sch nai be d public school there but as e be so na dem carry first and dem go houx wit flat screen TV of 32inch. His Majesty nai take second and dem go home with fridge and Obule sch nai carry 3rd and dem go home with DVD. This na just to give back to d community and dem don sign am say dem go dey do am every year. We encourage dem to do more of dis dan those naked dance wey dey add to the pollution of our society. Report reach us say Army don dey over do dis bike issue again as dem use wood flog both passenger and Bike Rider fall yesterday. Na so d Army tanda for Olympia dat evening as dem use one okada man bike take do wedge for front of Sapele palour wey people dey watch match. Fear nor let d guy near e bike. Army make unu nor kill our pipo hear oh, join d ones wey Boko Haram dey do our pipo for NORTH. Report just land our studio via Kpangolo motor say Mr Santos wey get Santos Hotel and Filling Station don finally drive that e small wife wey dem dey call Chichi commot from body as d girl wan use wahala kill Santos before e time. As we dey talk so na only Santos nai dey carry the pikin dey waka now. Santos don turn day care and baby sitter father. Report reach us say na Cyril Makanaki wey be Agbero wey dey collect money from Traders wey dey Road,wey Bobo almost beat some days back becos of Traders revenue wey dem dey collect and Okosisi wey fat like toad nai dey cos the downfall of our Football friendly match against Bayelsa United wey go make dem sign one or two of our players. Report still fly cum say IKE IBE hand still dey inside as Igbo don finish dat one life. As we dey talk so na N100,000 nai dis thieves dey collect from Bayelsa United chief coach for every match wey dem play as dem dey lie say dem dey distribute the money give fans wey come cheer d team up,so dat fans go dey come always and d home team go dey get support. If unu use Deve pursue dis Bayelsa team nai be say unu suffer don enlarge be dat. *PASSAGE TO THE GREAT BEYOND We all for Studio sidon for ground dey cry over the death of Late Pa Smart Gabari Ogbimi the former owner of the most busy Ashawo Hotel wey dey Adeola Rd, wey one church from Benin don come take over now. We all dey cry as we wish Pa Ogbimi farewell. Report just blow enter our studio from TAFIA OGBEGBE say dem do one birthday for Oxford Hotel d groove na die as all Ashawo dey d ground who do d birthday we hear say she tax d girls 3k each for gift and 5h for spraying tins. Na she be d head Ashawo for d Hotel. Report reach us say one Girl wey dem dey call Juliet for Ugberikoko carry Belle. When d family begin beat the Girl to talk who give her Belle she say na Captain Sule wey be Army for Ugberikoko checking point. Wen our team go investigate d issue we come find out say na lie d Girl dey lie becos dat checking point nor get any Sule. Weda d Army fake name for d Girl now we nor know. Unu wen dey friend Army to intimidate unu Boyfriend dis na d kain result wey unu go get. Report use Aaron B shamughe body take run enter our studio say thieves almost vandalize Jimoh Barbing Saloon wen dey Abeke Rd close to Texaco Fuel Station. Wen we use our torch take view d report, we con see say d jakoliko pipo nor fit break in becos of d wood wen dey d ceiling na dat pepper eye nai make dem capitalize on d PVC with destroying. God Bless Sapele SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Wed, 23 Apr 2014 19:38:03 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015