Pls my friends i need una help here bcos i dont pray and even writ - TopicsExpress



          

Pls my friends i need una help here bcos i dont pray and even writ to oga Jona on top but no answer yet. I been suggest make he help us transfer the subsidy he remove frm oil to woman. My dear since dis subsidy tin women don come cost wella. Imagine for her to like u, blackburial, to accept ideath to love u nko heh dat one na ifatal. D one wey d pain me now na hw much we dey pay to marry (dowry). I see list wey de give my friend last month, na him i faint even say no b me want pay. Na him dis gal i just tell say i like am for 2go come dey ask if i go marry her. Pls i know say cheap tins na him de kill pass for dis country but even if u kick bucket,drun or jerrycan, kick na kick. Pls i need where cheap women dey make i go marry pls if u hv an idea let me knw cos dat least wey d give my friend no be here. D tin wey pain me pass be say d papa say na graduate. My friend follow buy book ooh, buy her cloth,give feedin money even follow pay skul fees. Na d guy even buy jamb form we she take enter skul. And even lecturers don collect some litres of the oil. God judge this case ooh b4 2018 wey i go marry
Posted on: Tue, 25 Jun 2013 09:32:26 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015