Psalm 23 in Pidgin English (Pidgin Bible) 1. The Lord na my - TopicsExpress



          

Psalm 23 in Pidgin English (Pidgin Bible) 1. The Lord na my shepherd, I dey kampe like eba igbo. 2. E make me sidon for where better AC dey flow like skye bank hall and come put me next to stream make my body dey thermocool. 3. E panel beat my soul come spray am white, come dey lead me dey go through Badagry express road because of Hin name sake. 4. Walaii! If I waka pass where arm robber, higher killer come even join boko haram reach valley of the shadow of death self, liver no go fail me. Your rod and staff nko? Na so dem dey like backbone dey comfort me wella. 5. You don arrange better food on top table make I chop. See bad belle people dey look me sey i too like iya kamo food. u com rub me for head with vaseline intensive lotion. My cup come be like Marwa road @ satellite Town wey erosion dey waka pass. wey government no fit stop am (God u are too mush) 6. True true, better life and endless mercy go dey follow me waka till I quench. And I go tanda for God house... lai lai I no go comot for wia better life dey yarn. God Almighty, Na you i beg Joo biko! please AME-Amin-Amen
Posted on: Tue, 11 Jun 2013 22:47:02 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015