SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 05/09/2014. I sidon for - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 05/09/2014. I sidon for ground with my black and black dey mourn the death of one of our illustrious son wey die cold death from the hands of some persons,wey give me the right to call Sapele Amukpe axis Alu-Amukpe of Sapele. Na Lugard Tebu, Felix Pemu, Charly & two other persons nai use hand beat Late Mr Gift Egboro to death for Igbeku (near Vitafoam). These people claim say na becos Gift Egboro a.k.a TIDON go collect N500 wey he take guide wood,wey dem use build House for the Community and him na Vigilanty member. Dem say e nor suppose collect money. Na from clap nai dance dey start. As dem dey argue nai dem dis-arm the guy,push am for ground begin maltreat am anyhow. Like play like play as dem dey beat Gift,e begin shout say e dey loose power. Them nor relent,dem beat Gift like who thief Community Transformer,until Gift come die. When we carry our searchlight face the people wey do dis evil act for Sapele,i cum find out say dem be Community Youth Excos & dem dey oppress people dey take their land and dem say any money for the Community must pass through dem wit oppression. Dis persons record for crime,dey very suspected and i go keep quiet becos this case don land for Court and i want make the Court do deir work independently due to say; * I nor wan compound problem for them,as i want make deal with dem with wetin carry them go dere. * I nor wan at any junction intrude make the Court nor cum over react becos e go be like say i go cum dey open more files. etc The thing wey interest me pass for this matter,na d speculations wey dey roll for town now,say Hon. Austine Ayemidejor dey back this evil doers and say he dey make move to go bail dem,after dem do dis evil act for our society. I nor fit fear darkness shit for House,if unu ask Solo Abeke well,e go tell unu say the only Sapele Okpe Politician wey i like and wey dey do well for Sapele na Hon. Austine Ayemidejor and wen i hear say e wan pass back go release this Alu Youths wey beat Gift to death,my body nor do me well,as i throway special Call give am via my Ghost Line1. First Oga nor pick,nai i call somebody wey dey control the CCTV for Vitafoam side for Amukpe,wey tell me say Oga travel. E nor delay pass 15minutes wen i drop my phone,nai Oga roam number take call me from U.K wey e dey. After pleasantries as usual,i cum put the rumour to Oga,say e dey use e contact wan take release dis evil doers. Na for dere nai e for tell me say,e nor go fit do such thing becos him na public servant and as e even hear about the incident,nai e dissolve the exco. And also him dey outside Nigeria and e nor get hand for any murder case. After our 35 minutes conversation,i cum find out say e hand nor really dey and e nor get interest to bail anybody. So i dey use dis update to call on unu wey dey rope Hon. Austine Ayemidejor join dis evil ones to stop becos e don give us e words and we throway our CCTV for d case to make sure say e nor go one sided. I Chief Okpubuluku challenge any Court,be it High Court or any where say i dey very interested for this issue and i go drop my last blood to make sure say justice takes it course for this matter. If people from Sapele nor fit learn from the incidence of wetin make big name Bando dey one side nai be say na extra ordinary thing nai we all dey find for dis town. Who nor do well go see anyhow. Becos dem make some persons Vigilanty heads for dis town,dem don begin take laws into deir hands. Dis na clear example to checkmate dis vigilanties,becos i nor fit imagine say Police,Navy,FRSC,VIO, and ARMY dey town,yet dem still go add Vigilanty join,cum empower them with Guns to dey molest people around the town unlawfully. Nemesis go always caught on them and dem don use deir own hand take kill deir own member. Atink wen we dey complain say dis Vigilanties dey molest people,dem say we dey talk anyhow? Wetin cum be dis now? *My people Vigilanty dey do us more good or more harm? *Make dem allow dem dey use Gun or Not? *Wetin be ur take against this people wey Kill Gift? Na Me The Otota1 Of Sapele. The Urhukpe1 Of Okpe Kingdom. The Asamaigor1 Of Itsekiri Kingdom. The Eagle Eyes Of Delta State. God Bless Sapele. MAKE WE ALL JOIN HANDS TOGETHER TO WISH GIFT FAREWELL. REST IN PEACE GIFT EGBORO a.k.a Tidon. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Fri, 05 Sep 2014 06:40:02 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015