SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER 20/06/2014 KENNEDY THE HONEST - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER 20/06/2014 KENNEDY THE HONEST BUS DRIVER For inside Kolo quarters, Kennedy dey stay one room and e dey pay rent of #500 every month. Na wheel barrow e dey push for market. As God come doam, after about 6 months wey e dey push the wheel barrow, e friend come introduce am enter conductor work. Na from conductor work e oga for come teach am how to drive bus. One day, e oga nor well, e come tell e oga say make the oga let am drive the bus take hustle that day. E go find conductor use. The oga come give am go ahead. That day, e come go Olympia go carry Lucky wey be conductor make e dey shadow for am. Dem come work till 7 oclock for evening. Becos of e honest behaviour, when e oga see the money wey e give am, e oga come dey happy say e go still allow am use the bus the next day after all, e body norva dey ok. Na so Kennedy take use the bus for that full week. One day, rain dey fall for Sapele. Mr Wellington wey be maketing Manager for Eternit dey drive dey go work around 7 45am when e notice say e BMW 5 series engine dey bring smoke. As e park, e come come down with e big umbrella open e bonet. After e don know say na overheating. E come dey wonder how come even when rain dey fall and the temperature guage nor dey read high. Where e for say make e lock the motor becos e don dey late make e for take transport go work, nai dem call am from office say make e nor late come o say Auditors don dey the company dey wan start work today . Mr Wellington lock the car, stand for road with e umbrella and handbag wey documents wey e wan present for the Auditors dey. E stand dey wait motor. Once nai Kennedy drive come. Mr Wellington enter front. Na olympia e suppose come down. But as other passengers don come down remaining Mr wellington, e come tell Kennedy make e go drop am for office. Kennedy just believe say e don hammer as e nor just talk go payment. Sometimes, when you go see how person be, you go know say money nor go be e problem. How much e go tell person like this wey e nor go fit pay? So no need to price. As Mr wellington come down from yhe bus, na hurriness e take enter Eternit after e don give Kennedy 2k from e coat pocket. Thank God, the Auditors dey with the purchasing Manager. After him nai be the Marketing manager, Mr Wellington. Where e for dey wait e turn nai dem use intercom take call am from security post. When e reach there, na the bus driver, Kennedy e see with e handbag for hand. What? Mr wellington nor believe say e forget bag wey contain Company cheques and about #200,000 for inside bus. By now, the rain don stop and e don already call e mechanic make e come collect key to go carry e motor for New road. E dey think say na the Mechanic come wey make dem call am. E mind nor even go say e forget bag wey e need for the auditing. Sometimes, some things in life go make us forget wetin we suppose do. But e get divine purpose why every mistake dey happen. As Mr Wellington zip the bag, e come check everything inside. E come put hand for pocket, bring 5k nai e stretch am for Kennedy. Kennedy just tell am thank you e come start to go. E nor collect the money. Person wey get good character nor dey suffer for life. Money nor dey change person wey get good integrity. Lai lai. Mr Wellinton come go back to the office go meet the auditors. Thank God, out of the four managers wey dem audit that day, na him own records nai nor bend. Where e for dey wait e mechanic make e bring the motor come, nai the production manager come tell am say, Managing director driver say e wan resign becos of too much Air condition wey e dey sidon put for motor. E dey get rheumatism now and doctor advise am say na the AC dey cause am. And na the production driver wey be MD mainest man nai MD tell make e bring better driver. Production manager say e nor know anybody. Na there Marketing manager for come remember the bus driver. But e nor get e contact. Good nor dey lost. If God open your file, whether light nor dey, dem go read your blessings. Mr Wellington mechanic come bring e motor. That evening, e come go Olympia go wait for Kennedy. When God don pick you, anybody wey E destine to help you, ready to find you and wait for you till you show. When Kennedy finally meet Wellington, Mr wellington come give am load down. E nor get driver license. And e nor get good clothes wey e go wear go meet the MD. Mr Wellington come help am buy one trouser and one long sleeve with tie. And one good pair of shoes. E still help with money for the drivers license. In the end, dem come give am the job as Eternit MD driver. When you try to pay good with good, all your enemies go start to pray for you. Levels don change now. Kennedy wey dey manage e life with less than 7k a month befor, and e nor dey complain becos the money dey reach am, don dey receive 80k a month. E first pack go self contain for Atufe Road. E do chair for house. For the first three months, the money dey reach am remain befor month dey end. But from the fourth mouth go, Kennedy nor dey get change sef for month end. But na better life e dey live now. When you dey honest and get good integrity, nothing go fit change you. Person wey fit control himself, dey very God fearing. And when you get integrity, you must get the reward. Which one good pass to get my pipo? A. Money. B. Integrity. C. Power. Give your point. I dey go buy sense for Nandy Supermarket for all these our Sapele girls wey dem break their caravan even after dem don open give Army. God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER
Posted on: Fri, 20 Jun 2014 13:25:02 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015