SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 30/06/2014. Hon Julius - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 30/06/2014. Hon Julius Egbedi. I stand for Amukpe Death trap roundabout dey sing praises to God becos death rate for dat junction don reduce well well but dat one nor mean say the place good. I don think am well well say you Hon. Julius Egbedi wey happen to dey lucky as d Caretaker Committee Chairman of Sapele Local Government,nor get better leadership quality and selfishness nor let you know say,good name better pass wealth. Na fowl you dey train,wen u commot from Vice Chairman office and you know wetin be hardship small. If nor be say dem manage pay you your accumulated impress,you for nor fit buy ur Camry. Since the inception of this demolition everybody just turn face commot from ur corner but you forget say who dey cry dey see. Allocations dey cum the local Government since the past 3 months and i go nack hand for chest say u norva fit execute one meaningful project from ur constituency. The real Egbedi don cum out now,and i go tell you say,as you dey save money for your Oga to use during Campaign becos u dey feel say,power go still retain for ur Oga hand so that dem go empower you again,but u nor know say d good name wey you put for ground nai go determine your popularity to bring you back into any elected office. Egbedi you wan be Boy till u go die? Try be the man of ursef and refrain yourselve from bad Government. See dirty wey dey New Road since,na to rent Caterpillar worth N40,000 daily to push all those dirty go inside,but becos of money wey you dey focus the divert nor make you know the importance of doing the right thin,to push the dirty go inside perfectly well. Atink State Government don come helep you clear the place well now. When you see the place how e be you for body? I dey shame for you badaly becos you nor be like who go fit lead for bigger office,becos your Loyalty to ur Oga at the Top dey too pronounce,to the detriment of Sapele. To service the Trucks wey dey go carry Dirty from Market environment during market sanitation na big problem. I don dey try imagine the things wey u dey use our Allocations dey do but i nor get any major thing. Na you dey pay Salaries half for Sapele. The Comprehensive Road projects wey u claim say u do na rubbish,as rain don watch the road finish. See all the spots and Slabs wey you do follow market surroundings, don break finish. Yoruba Rd by Hausa Rd wey u patch don open mouth again. If you agree to manage do small project,na inferior nai u go use,all becos u wan deceive ursef say u dey work,and yet na rubbish u dey do. My friend make i just simply advice you today,say make you go dat New Rd wey State Government clear for us,to go peg Bulb Wire round the place den do Pendestran lane to allow people dey waka dey go d end dey go throway deir dirty becos as dat Federal Road clean so,e good make we maitain the place very well,so dat e nor go return back to that apology state wey e dey before now. Hon. Julius Egbedi wetin be ur contribution to Primary and Secondary Education since you take over the Council? Wetin be ur contribution for Health? Wetin be your contribution to Road repairs? Wetin be ur contribution to Security? Wetin be ur contribution to improve the lifes and welfare of the pipo? Wetin be the projects wey you don execute within your stay for this Government? etc Na who follow king argue nai dey kneel down tey. You don fail Sapele people,with ur attitude of dishonest leadership,and i go put am to you and your Oga say na unu nai dey make we from Sapele dey see say PDP nor good,becos if unu really dey utilize the Allocations wey dey come Sapele well like other places dey use deir own,we for atleast dey rejoice say Democracy still reach dis side. But with unu greed and carelessness,including Hon. Paulinus Akpeki and others, Sapele nor get any better tin to show say dem don benefit from PDP. Hon. Julius Egbedi wetin u wan tell Sapele people say be your achievement for this almost 2years wey u dey this office? NOTHING. Make i nor lie for you,you dey answerable to the allocations wey dey come d Local Govt since wey u and ur pipo done code for one side. And with this i dey proud to tell you say you don drag unu Family name go down well well,becos i nor sure say Sapele people wan hear Egbedi for political issues again. I Remain The Otota1 Of Sapele. The Urhukpe1 Of Okpe Kingdom. The Asamaigor1 Of Itsekiri Kingdom. The Eagle Eyes Of Delta State. Make i rush go my BEDC work,make dem nor go sack me. COUNTDOWN TO SHUTDOWN THE STUDIO PERMANENTLY DONE DEY LOAD. God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Mon, 30 Jun 2014 07:24:12 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015