SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER BE TOLERANT Papa Funmi waka - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER BE TOLERANT Papa Funmi waka enter him parlour where mama Funmi for lay down for the three seater chairs with eyes wey she fix for the wall clock dey wait Funmi. Woman, so you still dey here. You better go and look for your useless daughter befor day go break. Or this house nor go contain me and you. Pikin wey norva reach 21 years nai don dey waka ashewo waka. Like daughter like mother. He come waka go check whether the door lock when e notice say time don dey pass 1 oclock for morning. Mama Funmi just dey cry dey complain for her mind... God, this pikin norva waka like this befor. Wetin come dey happen? Her phone nor dey go. God, nor let the enemies give me bad name o. Papa Funmi come turn back See, I dey go room, befor piss go catch me, make sure say I nor meet you here otherwise, na your dead body I go carry go meet your family. As you say you nor fit train your only girl pikin well so, me go teach you lesson wey you go take learn how to train girl pikin Where he for dey waka go room, nai be the door hand wey dem see say e dey turn. The mama come rush go open the door. Na Funmi! That night na Easter groove. Funmi with her friends go Event Galleria go flex. From there nai dem carry her go straff befor she come come house. Her papa come turn back go meet Funmi wey don fall for her knees dey beg. Papa, am sorry. I nor know say time don go like this. E nor go happen again Her mother come join dey beg e papa. Say after all, she dey University. Even if Funmi na graduate, or dey work for oil company, as long as say she still dey under my roof, As long as say she norva marry, And as long as say na me born her, she must obey my authority for this house. E come start to loose belt from him waist. Mama Funmi come dey look am. Wetin you wan do so? Flog her? You wan flog girl pikin wey dey university say she follow her friends go enjoy Easter? She come back, you wan beat her. Nai be say, if suppose she nor come back like many other Sapele girls, nai be say na kill you go kill her. She come tell Funmi make she stand up go her room. If you move! Her papa come shout. You dey crase this woman? Make you dey spoil your pikin for ground but I nor go let that happen. Not for my house. As he raise he hand make e hit mama Funmi, nai she hold her hand. Wetin dey worry you sef you this useless man? Na now you wan act as a man abi? When you buy Funmi under wears last? When you give her pocket money to buy wetin she like as a girl make she for nor depend on any boy or get boyfriend? As she dey talk, nai her husband start to beat Funmi. Who unu wan turn to fool for this house? Where mama Funmi for dey fight her husband, nai Funmi open door start to run go outside. Na so her papa begin chase her with cutlass. As she open the compound gate make she run come outside, nai be bullet wey hit her for belle. Some armed robbers dey rob for the area that night when police start to chase dem with their Hilux. Na as dem dey drive na so dem dey shoot till one stray bullet kill Funmi. As the papa hear the shout of Funmi, na so e drop the cutlass. Befor e reach the gate, Funmi dey ground dey gasp for breathe. As e mama reach there see Funmi dey bleed for ground, na so she burst into cry. Funmi. Funmi. Nor make me childless. God, nor take the only star from my sky She dey cry. Her husband dey cry. Funmi don die. May her soul rest in peace. Amen. My pipo, anger nor good o. Na God dey give person good pikin. Nor be by harshness dem dey take dey bring up pikin wey go good. Make we dey treat our children with respect. E nor mean say becos na we born pikin, we nor go observe the pikin rights and respect some of their actions. Correct pikin with love. For this issue now, Who we go blame over the death of Funmi? Funmi? Papa? Or Mama? Make we learn to be tolerant. God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Wed, 23 Apr 2014 14:40:11 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015