SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. MOTHER-IN-LAW. I beg, make - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. MOTHER-IN-LAW. I beg, make we all put hearts together to view this issue of mother in laws with okporlor eyes so that we go fit correct many things wey don go wrong for our homes becos of mother in law wahala. And for those of us wey norva marry, make we sidon with ear glasses take hear well to make us fit learn wetin go make us live peacefully with our mother in laws. When woman born pikin, na struggle to bring the pikin up. Some mothers dey really dey do their best to make sure say their pikin grow up to become good person for life whether na boy or girl. Na the way mama and pikin life be nai dey show how close them be. Many good children dey always dey appreciate their mother by being very close to dem, buy dem gifts, take good care of them. Now, when time don reach for the pikin to marry, the mama go dey think many things - the pikin nor go get time dey attend to her like before again. - the person wey the pikin wan marry fit suffer this her pikin wey she love well becos say many human beings bad well. - becos dem know how d pikin take struggle become who e be today, if dem go marry now, the person fit scatter their pikin money for am. At the end, d pikin go come dey suffer. All these thoughts na becos d mama love the pikin and she wan protect am. But she forget say, na joy for pikin to marry commot from your house. She forget say, the pikin still get sense to know what is right and what is wrong. But if we look am, e get some mama wey love who deir pikin marry in the beginning of the marriage. But as time dey go, she go come develop hatred for am. Why? 1. Pikin wey dey buy things for e mama before and give e mama money before, all of a sudden, e come stop to dey give e mama. 2. Pikin wey dey always dey call e mama and go meet e mama for house wella before, all of a sudden, e come stop. Make unu ask unusef this question. If na you be the pikin mama, you go dey happy? No. We agree say, many mama in law like trouble wella. You fit dey good to dem, yet, dem go still dey wain your barrack. -when some come your house, dem go dey complain say you dey waste their pikin money becos of your heavy pot of soup, heavy clothes and things wey unu buy for house. -you die well if you be woman wey norva born or you don even born but you norva born boy. The wahala na pan. -some mother in law wey don get who dem want make dem pikin marry for ground before, as dem pikin nor marry that person, dem go dey try everything possible to scatter the marriage. We nor dey say you right or mother in law wrong. If you know say you nor dey agree with your mother in law, nor worry. HUSBANDS 1. Know say this your mother in law nor be your age mate. 2. Respect your mother in law the way you suppose respect your elder or your mama if you dey respect your mama at all. 3. Some men wey dey quarrel with their wife or even beat her in the presence of their mother in law, na very bad thing unu dey do. Make unu stop. 4. Nor dey run your own mama down for your wife. E dey make your wife see your mama finish. 5. No matter the offence your wife mama commit against you or the offence your own mama commit against you, clean am from your belle. You nor be juju wey nor go forgive. Go buy wrapper, put money and drink go meet your mama or mama in law make you make peace with her. Forget who dey wrong. 6. Always dey send good packages dey go give your mum and mama in law. 7. Spend good time with them with your family once in a while. WIFE 1. Respect your mother in law becos na your second mama and nor be your age. 2. Tolerate many things she dey do and talk. Many of them dey behave wrongly becos of the over or excess love dem get for their pikin. 3 nor dey run your mama down for your husband. 4. Nor dey tell your husband some kain bad secrets about your family. Marriage nor mean say you nor get sense. Wetin you tell man with laff nai e dey turn to weapon when unu dey quarrel. 5. Always remember your mama. Buy her things and pay her visits with your family. If you dey take good care of your mama, she go like your hussy. 6. If you dey in bad terms with your mama or your mama in law, go resolve with her. 7. Even if your mama in law dey do wrong things, nor insult am nor talk back at her. Na pikin wey nor get good home bringing and sense nai dey insult and quarrel with elders. Bear. Bear. Bear. MOTHER IN LAWS 1. See your pikin in law as your own. 2. Nor transfer the bad thing your pikin do you to e wife/hussy. 3. Always pray for your inlaws. 4. Understand with your in law sometimes when things dey go wrong. My pipo, I nor intend to write this message twice. So, I dey beg all of us wey dey get am tough with our in laws, make we go settle. Many cases, na the mama dey just dey find trouble. But make we respect our mama for the simple fact say na she bring us come this life. How long dem go stay this world? So, make we use our brain. Nor claim right with your mama in law. Condone her and God go help us. Make we respect our mother in laws no matter what. I dey happy when I dey see some young men for this town dey roll well with their mother in laws like say na she born dem. E good. Make I end here so that you fit add your own. But no matter wetin you talk, the end thing we dey talk about be say, go make peace with your mother in law if unu nor dey in good terms. Forgive her and God go bless your marriage. Na ekapa man nai dey sidon fold legs when e wife nor dey agree with e mama. GOD BLESS SAPELE. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Fri, 07 Feb 2014 15:22:26 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015