SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. The Delta State Commissioner - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. The Delta State Commissioner for Housing, in Nigeria, Chief Paulinus Akpeki 7th of July 2011 nai dem appoint you as Commissioner for Housing. Dis position wen dem give you na to represent the Delta State Cabinet of Political and Governmental Exco. I clap for u becos na u be the Jerigana of Delta State. After all u dey mianda your way into every Government for Delta State. Chief Paulinus Akpeki a.k.a UGO1 of Africa. As greetings nor dey finish for Palace,na so insult nor dey finish for Thief wen dey Prison body. If dem say,mak we call one Political person for Sapele wen done old for Delta State,ur name nor far from dat position. The last Senatorial Election for Delta Central here,u helep ur Party play major role to win d Wards wey dem share reach you. I nor wan insult you today,but as the OTOTA1 of Sapele and d Urhukpe 1 of Delta State,i wan ask u just dis Question. WETIN U DON USE UR CONSTITUENCY PROJECT MONEY TAKE DO FOR SAPELE COMMUNITY WEN U DEY REPRESENT? I know say if unu wan lie for question wen we dey ask unu,unu go say na Ogboren,Adeje,Elume,etc Unu go dey call names of villages,lik say we nor dey go d Village sometimes. Mak i tell you,u neva do one meaningful project for Sapele and at ur age,i dey shame for you. Gone are those days wen u dey enter ur old Regular dey throway money for Sapele. Gone are those days wen u dey shout like who see Diamond pik. Dis na digital era of Politics. Wetin Sapele pipo go take remember you if u die? Oga Governor giv u sensitive position mak u pilot the affair of Housing for Delta State,u nor fit build Locust Estate,mak pipo rent and dey pay from deir salaries,so dat dem go benefit Housing structure. So dat if dem pension dem go commot from Tenancy. Our Governor personally build big Structure for Abuja through ur Office,yet u blind to assist Sapele pipo. If okro too long d owner dey bend am dey pluck. Today i go bend ur ear advice u,becos u dey commot from line all d time. If to say i dey talk without proof,e for nor dey pain me. Hon. Paulinus Akpeki me and u norva talk once for phone apart from d day we quarrel about Sapele Main Market. But u go dey use my name dey campaign say me and u na friend,and say i apologise giv u wen i write about u d last time. I naff u well well. Honourable Office nai u dey occupy and u still be High Chief for Palace. All dis title wen u dey pack full body wetin u don use am achieve? Call one tin for Sapele wen dem write ur name put,say na u fight,tear shirt for Asaba mak e cum Sapele Nothing. Na dis kain leaders we need for Sapele now. No. When i check ur team and entourage,na so so Delta Igbo u pack full body,as P:A, S:A, and odas. Wetin happen to Sapele Okpe pipo? Dem leg dey pain dem to go Asaba go follow u work? See all ur Papa children,na so kain kain dem dey drink follow Sapele. Well dat na unu personal life,mak i nor digress. Wen u dey address us for Asaba dis na ur statements, my first thanks goes to my Governor, who found me worthy on the 7th of July 2011 to appoint me as Commissioner for Housing, he noted. According to Chief Akpeki, all this while a lot has been done in the housing sector, which includes the first mandate to ensure the completion of all ongoing projects, one of the policy thrust of the administration. The Commissioner noted that Ministry of Housing is not only to build Houses but to complete all ongoing projects as well as maintain existing ones. In this regards, the administration of Governor Uduaghan has renovated a lot of government properties for instance we have been able to maintain twenty two duplexes which are presently housing the commissioners in Delta state and there is a new lease of life at the estate. There are other facilities there, including a long tennis court and a gym amongst others. We also went ahead to renovate and maintain the House of Assembly quarters, the Speaker and Deputy Speaker quarters, as well as for staff. We also went ahead to renovate and maintain the House of Assembly offices and complex. In his words the Ministry of Housing is not meant to build houses alone, but consult for other ministries under the building industry in Delta state, build public buildings with offices in the state such as secretariats and offices for establishments. He explained that Delta State is big with twenty five local governments, noting that, we dont only build houses in Delta state, we cover the country. As at today Delta State has one of the biggest tallest building in Abuja called Delta Towers. Chief Akpeki disclosed that the government awarded that contract in 2006 but because of the trust and support of Dr Uduaghan, he is privileged to complete the building now which has been commissioned and by the grace of God the edifice was commissioned in April. We are also putting up a government lodge in Lagos which is on the verge of completion, as well as other offices in Warri, Sapele. Delta state is a complex state unlike other states that have one urban city while Delta has not less than fourteen urban cities. When people talk of Delta they dont know that the state is not just Asaba, we have other urban centres. Asaba today is the fastest growing Capital in Nigeria, with an international Airport which was created in 1991 and today we have one of the best Airport. Today there are roads in places like Agbor which has taken a different dimension, and there is “the owner occupier houses ” for civil servants in the state to be paid for over a period of time. Hahahahahahahahahahahahhaha Hon. Paulinus Akpeki u try for sugar tongue,but see as u disgrace ursef and Sapele seat wen u dey represent for Asaba. All d edifice wen u mention No one dey d Masses favour. U say ur office na to also complete project and renovate structures. Wetin dey happen to Sapele Main Market and Stadium wen norva see completion? Sapele pipo mak unu join me today ask Hon. Paulinus Akpeki the Commisioner of Housing say wetin e get to tell us for our MARKET? See as our Parents dey suffer everyday dey shade deir Goods for under sun and Rain. Wetin we do unu for Sapele,if outsider dey suffer us,u go still join pack pepper for our eyes. As i dey so na cry nai i dey. Sapele big Men. Sapele Stakeholders. Sapele PDP. Sapele Community (Unu don fail). Sapele Students. Sapele Lawyers (wetin unu dey do) Sapele Women. SAPELE FUTURE LEADER (YOUTHS). Etc. Wetin we wan tell our Children say we achieve for Democracy of 14years old? Mak i go buy Towel and wrapper for the Osioh wife store wen dey opposite Stanley Maka Store,make i spread for ground sleep for Sapele Market gate,cry for our Parents stress wen dey suffer. Na me be the OTOTA1 Of Sapele and i peg my legs for ground say Sapele nor be anybody own. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Thu, 07 Nov 2013 06:29:43 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015