SATURDAY 11TH AUCHIPOLY NEWS MAGAZINE LIVE: UNA GOOD MORNING - TopicsExpress



          

SATURDAY 11TH AUCHIPOLY NEWS MAGAZINE LIVE: UNA GOOD MORNING OOOOO........ We don come back after we lost control of our CCT desktop system and we thank MR OBEMEHI and MR ONUBEBEH wen support us with sum high amount of money to take repair am, God go bless una as una dey give us more wings to fly.............. Report reach us say Auchipoly don dey cos confusion regarding dis ND admission list as dem just dey paste batch anyhow since on wednesday, and now we don come hear say na 3rd batch nai remain to paste........... Report reach us say some HND Applicant don dey show school as regard their exam on monday and tuesday............. For those ND newly admitted students wen dey ask us how much and what dem go bring come for the clearance, una answer na to bring una complete file come............ Report reach us say d exam wen mechanical students ND2 write yesterday na die as d lecturer just change am for dem, hmmm oga abeg try pass dem ooooo........... We don receive report say house for campus 3 area when be back of ekhie girls school amount dey affordable as some self contain na 65k and single roon na 30k.............. We don still receive report about the departments wen dem go move go campus 3 next years as some go still dey take class for campus 2. 1 business admin 2 accountancy 3 public admin 4 marketing So make una rush go dey find house for those area now ooooo............ Many things dey happen for this school wen we our self no go fit talk as e go course wahala and casala, but we pray make God publish am com out soon ooooo............ Report don reach us say another Auchipoly tafia don dey as he dey use our names and every of our profile details, even our profile picture, but very soon we go get am as we don deploy 62 of our reporters to help us nap the imposter............. Sun wen dey shine for Auchi fit cook egg done as many students don dey complain especially d ones wen dey trek go campus 3, we come beg God last night nai rain begin fall, we thank God ooo............ Report don full our inbox say students dey complain say light no dey for dem to take read as hostel wen no body dey inside go just get light but outside no go get, hmmm make una better look into dis matter ooo bcos I know say small time students go change am for una ooo.............. Na here we go end our news today tomorrow we go give una our sunday news/live story programme so make una no miss am ooooo............... AUCHIPOLY EDO STATE MUST BETTER: NA ME THE OTOTA OF AUCHIPOLY D ONOGIE OF AUCHIPOLY D OTARU OF AUCHIPOLY D EAGLES EYES OF AUCHIPOLY Nai dey bring una dis news, abeg make I go supervise exam for campus 3, una bye bye...........
Posted on: Sat, 11 Oct 2014 06:54:05 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015