Somewhere near my house yestaday afternun, i just dey see one - TopicsExpress



          

Somewhere near my house yestaday afternun, i just dey see one of my Guy off to the bus stop when i see one clean beautiful girl come out from her SUV dey cry dey kneel down dey beg one slim bobo wen be like say him never chop for months,the babe just dey beg dey cry dey follow the guy dey tell am say she no need money, she no need brazilian wigs, she no want shoes, house or anything, she say she no even need the SUV all she want na him love, him kisses and him warm embrace, guys the babe just dey shout dey cry, when i hear those words my heart stop, my head spark and my brain burst,the guy no even dey look the babe sef na then me i vex say if this guy no value this girl well right now me i don fall in love be that so make i go claim this girl but as i near there, one man just touch me for back say oboy abeg no block the camera..Rubbish! na even NOLLYWOOD film dem dey shoot ...
Posted on: Mon, 27 Oct 2014 13:51:10 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015