TUESDAY 9TH AUCHIPOLY NEWS LIVE: UNA GOOD MORNING - TopicsExpress



          

TUESDAY 9TH AUCHIPOLY NEWS LIVE: UNA GOOD MORNING OOOO.......... Report reach us say madam rector and other top officials go hold meeting this week as regard wen first batch of ND admission list go come out so make una still hold patience small.......... Report reach us yesterday from computer science say the exam wen dem give dem b like ICAN exam as students no fit write anything becos say d exam too hard, abeg no use becos say u dey collect blocking take dey give students hard question ooooo hmmm there is God oooo and rector is watching oooo........... Accident almost happen for campus 1 gate as tanker almost run enter some students wen dey cross road yesterday becos say dem don late for exam, abeg make una dey use the bridge ooooo, becos na make e too quick nai e dey tay ooooo........... Report reach us say spat students don begin complain say lecturers no dey gree come teach dem again, bcos of the regular exam wen dey ground, abeg we know say una dey try make una still teach them even if na 30 minutes na something e b oooo......... We wan thank madam rector miss philipa idogho for her continuous good work in auchipoly, as she don make SEDAP a beautiful entrepreneurship centre, we pray make God grant you more years in life and in Auchipoly........... This na waiting somebody send give us yesterday.... Tafia i hail u n tanx u 4 d gud work u dey do 4 dis skul. Abeg i b nd final mass comm student, our project supervisor Pastor Ojo Idowu dey misbehave, he dey suffer students wit project sum people still dey table of content waiting approval while majority still dey chapter 1, my own case na chapter 1 n he don reject my own like 5 times without explanation. Abeg help us beg am or na Rector office he go see himself next oooo. Once again tanx 4 ur gud work, hmmmm if he reject am e mean say he no like waiting he see so make u go write am well before u go show am abi na d one wen dey collect money nai u dey find? Hmmm students una own dey una body oooo............ This na waiting another person send give us same yesterday...... Abeg oo I no undstnd hw lecturers com tak turn morning students to spats Oo. My younger sis for SLT ND1 dey write exam. Upon dat dem stil dey go for practical and test saturdays and sundays. Abeg una wan kill pple children? Wen dem wan com take read for deir exams. Abeg mak una treat dis issue cos e dey put our students for unecessary risks. I thank una vry much for d wrk una dey do tru dis forum. Una weldon, hmmmmm well d issue of saturday and sunday text even rector nor know how she go take handle am again ooooo as dem don stop am but many lecturer fit say dem too big pass rector hmmm na wa oooo........... This na waiting somebody send for us yesterday funny info......... Tafia abeg one Mr Adams working with the rector, his disturbing my girl friend badly, my girl friend hav told me every thing about the man, but as a train journalist of auchi. I am doing my own investigation about the man, if i am able to complete my information i wil tell u, but on ur own tafia mak u go food science and technology, ND1 morning students. Mak u send me ur number mak we talk wella. Becos my work nor dey give me chance help me out, 6years relationship nor be child play, hmmmmm for good 6 years u dey date dis gal only for one lecturer to come take am from you hmmm my guy u fit die put ooooo....... Lolllz........... Report reach us yesterday say nor be small tin dis people wen contest almost fight 9ice yesterday for hostel base on say 9ice go see good luck Nigeria 01 he nor carry any exco go even VP self but na another girl he carry go, wen dem dey quarrel him come say na 15k na dem give him for Abj dem come dey ves say dem need there share say d moni pass like DAT and y he nor carry dem go, hmmmm oga 9ice no come start another Sado for this SUG house ooooo u never stay reach 3 weeks u don spoil our SUG sienna jeep wen AM Xpress buy and now u don dey wan cos casala for the SUG house make u be careful ooooo............ This na waiting somebody send give us yesterday........ Oga tafia I hail ooooooo I warn thank u for d post wan u dey post we dey result frm ur handwork thanks once again My request nai b dis Abeg help tell mass comm exam officer n d class rep of HND 1 spat say make dem paste people result for board nor b house dem for dey check result with money nd as mass comm lecturers say dem go use student work finish collect enough money frm dem hand still give dem carry over abeg help us tell dem, hmmm result na board dem dey paste am put if buy tomorrow una no paste dat result na rector office nai una go sleep ooooo and lecturer make una still dey try help students how person go follow u work u no go fit even give am C hmmm na wa oooo............... Make una take note say dem no go sell change of course form this year ooo............. HND form still dey on sale and na 10,700 but the exam na immediately regular students finish their own exam......... ND admission list first batch don begin enter its final level as dem don begin compiling and ready to paste so make una still wait.......... Na here we go take end our news today, if u get any news or info make u inbox us and if u get advert make u still let us know........ AUCHIPOLY/EDO STATE MUST BETTER: NA ME TAFIA THE OTOTA OF AUCHIPOLY D OTARU OF AUCHIPOLY D ONOGIE OF AUCHIPOLY D EAGLE EYE OF AUCHIPOLY Nai dey give una dis news, abeg make I go see madam rector becos she don call me for meeting, una bye bye..........
Posted on: Tue, 09 Sep 2014 06:15:50 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015