U used BlackBerry to oppress,now everybody has a BlackBerry. U - TopicsExpress



          

U used BlackBerry to oppress,now everybody has a BlackBerry. U used ur camry to Buga, now boys dey use Camry do taxi. Before u dey use ur plasma tv dey swell.. now dem don dey use am watch ball for buka. B4 u dey use ur ipad dey swag...now ipad na heavy load to carry comot 4 house B4 u go dey use brazillian hair dey form big girl, secondary skul student don dey wear am troway B4 u dey go vacation 4 uk dey talk pass urself, boys don dey buy 1st class ticket dey enta london just to go lick ice cream.. BOTTOM LINE: no dey over do like say dat tin no go reach another person hand All na vanity, e dey fade like Aba Jean.. no 4get say tortoise car na big man motor b4 o.. Notin wey com wey no get expiring date, even d life u have na borrow u borrow am.. Humility na d best choice!!!... Happy sunday frnds
Posted on: Sun, 09 Jun 2013 14:45:24 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015