my people , how una dey? na good news i cari com meet una today - TopicsExpress



          

my people , how una dey? na good news i cari com meet una today O°˚˚˚, una wan hear the good news?i no fit hide am for una cos i wan make una dey benefit for the berekete offer wey dis we country dey offer,the good news na Nigeria Centenary page,d number one ogbonge page for facebook, d page dey give people beta tins wey u need for life, make una just search for Nigeria Centenary on facebook, na dere d real beta ogbonge tin dey apun, many programmes wey u go like dey dere, tell me wetin u dey find wey no dey dis page, me neva see O°˚˚˚,just click am for the like button, na federal government get the page, cos federal government wan come near the people wey dem dey govern, government wan know wetin dey apun for ur aos and wetin u fit contribute make nigeria turn the best country for the whole world,programmes dey well well, them get TGIC competition,wey u go take talk about wetin u think say e go beta nigeria, my brothers and sisters, if dem nominate ur entry na make you call ur pipu make dem vote for u cos if na u get vote pas, my friend u don turn hero, and celebrity be dat cos u go meet the pipu wey dem dey call Nigeria, shake their hands and even chop with our father Anyim Pius Anyim and other dignitaries,after that u go collect ipad or laptop and u don turn ambassador be that. Dem dey do history note, prediction of mathes and many more, the sun newspaper don dey even carry everything wey dey apun for d page and very soon CNN go beg us make dem feature us. my brothers and sisters wetin una stil dey wait for... oya tell your friends and the friends of your friends make dem come sharp sharp... God bless Nigeria Centenary..
Posted on: Wed, 25 Sep 2013 16:12:19 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015