tinkili news 1:30pm naijafm 102.7 tuesday 23rd december 2014. by - TopicsExpress



          

tinkili news 1:30pm naijafm 102.7 tuesday 23rd december 2014. by prof Wi oga presido, Goodluck Jonathan, don approve, say, make de pay kia-kia di three month salary, wey wi oga federal govt dey owe ein worker-dem for di ministry of educate-mata. ------------------------------------------------------------------------- One okpoka-man ontop weapon research work, Mr. Biedomo Iguniewei, don tell di corona panel wey dey point onyokomita ontop dat Synagogue church building fall-fall-mata, say, e fit possible say, wetin fall dat building fit bi one kyn high heat chemical bomb, wey ein call, ‘high energy infrasonic radiation. E say, e dey possible say, dat Aeroplane wey pipo see dey fly around dat building before di building fall yakata-so, fit shoot dat kyn weapon, wey pipo eye no fit see, b’cos dat kyn weapon dey waka with breeze. ------------------------------------------------------------------------- Di govt of Lagos state, don beg pipo wey dey stay inside di state, say, make dem helep dey trian pikin-dem wey no get papa and mama again, (orphan), for all dia special centre-dem, wey dey across di state. ------------------------------------------------------------------------- Di management of di national youth service corps say, de won reduce money from dat N4000 wey de bin dey charge NYSC-person wey won do internet online registration for youth corper-dem, wey won print dia call-up transfer-letter, if de no won go collect-am for dia own school. ------------------------------------------------------------------------- Di world bank don promise to support wi naija electric power-mata, with $1.75billion dollar oyinbo money. ------------------------------------------------------------------------- Wi naija electricity regulatory commission (NERC) say, na as from today de go begin collect di new electricity money, but de promise to dey give wi naija-pipo light wana-wana pass before. ------------------------------------------------------------------------- To helep Imo state pikin-dem wey won go home from Lagos and Oyo state for Christmas, di governor of Imo state, Rochas Okorocha, don carry free bus put for ground tomorrow, wey bi Wednesday 24, December to carry dem go Owerri. ------------------------------------------------------------------------- Bomb blow for Bauchi yesterday kill 6 pipo and wounjo about 19 pipo. ------------------------------------------------------------------------- Wi naija olopa-dem don promise say, de don arrange kpamgba security put for every where inside wi contri-naija, wey go protect pipo during and after dis wi Christmas and new year joliment. akata news Di new leader wey Tunisia pipo just elect, Beji Caid Essebsi, don yan say, with dis new vote wey de do so? di contri-Tunisia don enter new page comot from di hand of strong-head leader-dem (dictatorship), as di European observer-dem wey follo di election, follo clap for di process say, di thing waka mini-mini sion-sion, as de do-am with church mind. ------------------------------------------------------------------------- Di govt of North Korea, no gree follo kak inside one meeting wey di United Nation Security Council do, to take mouth touch all di poto-poto crime, wey North Korea govt don commit, as e take concern human right-mata. De say, wetin cause di fear wey make de no gree follo kak inside di meeting bi say? dis arrangement wey di UN security council start-so, de say, de fit begin use am dey arrange how dem go take grab di leader of di contri, Kim Jong-un, ontop how e take commit crime against humanity-mata. ------------------------------------------------------------------------- Di United Nation mission, wey dey for Central African Republic, say, di gbegee wey shele between united nation peacekeeper-dem last weekend dey worry dem for mind. sheree weree news De don promote Kwara United football club of Ilorin plus Wikki Tourists fc from di group a of wi naija national league, into di Glo premier league by di decision, wey wi naija football federation, take. -------------------------------------------------------------------------Wi naija U-20 team, di flying eagles, don call some nine akata professional player-dem and 21 other home base player-dem to join dia training camp for Kaduna, as from dis Saturday, wey dey come for front. ------------------------------------------------------------------------- Wi naija professional football league champion, Kano Pillars go jam Malaika FC of South Sudan inside di 2015 CAF champions league preliminary round and Enyimba FC of Aba go con jam Buffles du Borgou of Benin republic. jolly-jolly news One of wi naija young bobo musician, GT da Guitarman, don release ein latest music album of 16 track, wey di title bi ‘Baked’.
Posted on: Tue, 23 Dec 2014 13:16:16 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015