Akpors was found crying his eyes out and sitting on the floor in - TopicsExpress



          

Akpors was found crying his eyes out and sitting on the floor in front of his house; worried that he may have lost a relative his neighbors went to console him and ask what was wrong, Akpors still crying, narrated his sad story below: This morning I just dey escort one of my visitors to the bus stop from my house when I see one clean beautiful girl come out from her SUV dey cry dey kneel down dey beg one slim bobo wey be like say him never chop for months, the babe just dey beg dey cry dey follow the guy, dey tell am say she no need money, she no need brazilian wigs, she no want house or anything, she say she no even need the SUV all she want na him love, him kisses and him warm embrace, the babe just dey shout dey cry, when I hear these words my heart stop, my head spark and my brain burst, the guy no even dey look the babe sef, na there me I vex say if this guy no value this girl well right now me I don fall in love be that. I just dey think of how my life don perfect as I don sight this kain perfect babe for Naija, the kain babe wey dem say no exist; I just start to waka say make I go claim this girl but as I near there, one man just touch me for back say; Mr man abeg no block the camera, na film we dey shoot and those people na actor. CHAI!! CHAI!!!! CHAI!!!!!
Posted on: Sat, 13 Dec 2014 12:10:52 +0000

Trending Topics



iv>

Recently Viewed Topics




© 2015