Conversation between AIDS & EBOLA: AIDS: na who be dis - TopicsExpress



          

Conversation between AIDS & EBOLA: AIDS: na who be dis too? EBOLA: bro na me oooo, ur sis! i don show AIDS: Which kind bad market b dis na, watin carry u come EBOLA: Hmmmm bros why u dey yarn like dis na, ur reign never do u? Abi na only u dey dis world. I even hear say †hεm dn find cure fr you. AIDS: So who give u transport come Naija? EBOLA: Bros na one man from Liberia ooo. Him say make i accompany am come Nigeria. As we reach na him only me waka comot. AIDS: so hw u want operate here? EBOLA: My plan b4 na to follow all d state wey get d same alphabet wit my name... Ebonyi, Edo, Enugu, Bayelsa, Bauchi, Benue, Borno, Ogun, Oyo, Ondo, Lagos, Abia, Adamawa,Akwa ibom, Anambra. But nw me dey hear say all dis pastors n mallams 4 naija don dey chuk mouth 4 my matter. AIDS: mehn na bad market b dat o! Dose ppl strong die n dem plenty EBOLA: I swear d matter jst weaken my body like dis, to comot lagos sef na wahala.. Wey b say other countries dey shiver @ d mention of my name fa, naija boys dey here dey carry me do status... Dem no even fear. AIDS: #Lol shey u been dey form Baddo 4 Liberia,,,, me self i want to upgrade...... Na through air i want carry dey enter pple nw bcos condom don turn accessory for naija boys body.... Dem don even start dey hawk condom 4 hold up nwadays. EBOLA: bro i bin here say boko haram dey worry for north? E b like i no go reach der ooo. I no wan die AIDS: Market no dey move der again ooo... lol......Just for fun Stay safe, EBOLA is real.... May GOD protect us all #STAY_SAFE
Posted on: Wed, 06 Aug 2014 06:24:28 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015