Once upon a time Indomie was costly, Naija carry news say indomie - TopicsExpress



          

Once upon a time Indomie was costly, Naija carry news say indomie dey kill - everybody begin avoid, Indomie drop price In this same country Beans became expensive, them say killer beans dey. People stop to chop beans. When the price reduce, we start to chop beans again At a time Ice fish became expensive, Naija carry news say na mortuary them dey freeze ice fish, people begin avoid ice fish till the thing cheap Even chicken became expensive, Bird flu show, chicken price reduce. Since then we still dey chop chicken ooooo, No bird flu ooo National Association of Bitter cola Farmers don dey find way to improve market. Them say bitter cola dey cure Ebola, bitter cola don dey expensive 4 market now oooo: Dangote salt don come out this morning now say nah Salt de cure Ebola:O May be 2moro morning dem fit say: Shawama, 2much airtime for fone, point and kill fish, and expensive hotel room dey cause Ebola - nah that time Naija babes go dey follow guys go family house. Dont you think Brazilian and Peruvian hair can also transmit Ebola? Bush Meat is quite expensive than any other meat in the market - thats a fact. The question is this ....... NA 2day we don dey chop bush meat? WHEN WE NO SAY EBOLA DEY SOM CONTRY OVER 30YRS NOW? ABI DID D LIBARIAN MEAN KISS OUR BUSH MEATS?
Posted on: Sat, 09 Aug 2014 18:39:27 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015