P.m News/Updates. 03/11/2014. Report enter studio today say - TopicsExpress



          

P.m News/Updates. 03/11/2014. Report enter studio today say nor be small kasala nai burst for Koko dis morning,as the Community people enter street begin protest,becos one female soldier undress koko community masquarade. When them begin do the wahala,nai Hon. Francis Maku and some Community leaders come involve themselves,as dem calm the air down. Kudos to Hon. Godwin Ebosa wey dey throway phone calls from all ends to make sure say the kasala nor lead to bloodshed. Army make unu dey take unu time sha. Report enter studio say nor be small Bottles nai Boys break for Mega Planet yesterday wen dem dey dance dey go for Night becos as BEDC Seize light,nai d Boys begin vex dey break empty Bottles wey dey deir front becos the Management of the place wan close but the small small children nor wan gree go House,as after 12 for midnight dem still dey dance dey disturb the environment. Mega Planet i dey come for unu. Report enter studio say na every first Sunday of every Month nai be thanksgiving for Redeem Churches all over the world and dis Month na very special month for Open Heaven Assembly of RCCG wen dey back of Okurighwre market,as November na many of d church members birth month, all d celebrants cut birthday cake courtesy of d church. The Choir over try yesterday even though them they very few in number. The Pastor of the Church PST Chwukuka preach on d Topic; ALL THINGS WORKING TOGETHER FOR YOUR GOOD and d text na from Romans 8:28. Pastor i hail you. We dey thank all Safarians and friends of this great forum wey visit inbox for that Girl Appeal wey i throway for air yesterday. As at dis evening almost about 6 people don respond to send something to her to assist her run her Schooling programme finish without the disturbances of lack of Finance from her Family. Na God go bless unu and we still dey expect more persons to assist becos we norva meet the said target. Report reach our studio say bad boys don dey target keke for d town as d town don record d stealing of 6 keke. Just yesterday, dem snatch few keke wey be TVS. Na dat bad act nai make police tanda for Olympia dis morning dey search endlessly. We dey use dis update take dey alert all keke users to dey vigilant agst all these ekuneke pipo. Report nack our studio mast say na today nai Daniel wey be Literature teacherand also d best obito drum beater 4 sapele do he pikin Naming ceremony 4 ugberikoko. All dem Angelo Ireto security, Prince most popular, Churchill kobo leg, Etaferi mr report and Mr Ovie d peacemaker dey there. Na so dem tanda dey chop, dey drink and dey make yeye noise. Atink unu chop and drink leave me? Report reach us say one keke get beta accident yesterday along New Rd by Edahirere junction as motor jam d keke siagbe go one corner. D keke na brand new TVS and naso d keke squeeze like Churchill Amedu face. We dey caution all dis keke pipo to easy so dat bad belle drivers nor go use dem take do free suya. Olympia witness massive gridlock dis evening as cars, buses, lorries, keke and stuborn Okada juss dey rush anyhow. We dey call on relevant authorities to dey always dey man traffic their every evening to reduce d high level of traffik jam wey dey disturb vehicular movement. Unu knw say na Olympia be our New York for Sapele, only say our leaders refuse to beautify d place. Report enter studio say some yeye Boys don dey over dey disturb bikes illegally. Na so dem fall one Okada man and one Girl dis morning for Olympia. When i check the guys record dem nor even dey the list of Task force wey dem give interim order to dey disturb Bikes. I dey use dis update dey call on Hon. Ben Igbakpa to caution dis said Boys becos dem carry do,don dey wan too much for the town. IF GIRL SEE HER MONTHLY PAIN REACH TWO OR THREE TIMES IN A MONTH. WETIN DEY CAUSE AM AND WETIN BE THE REMEDY? God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Mon, 03 Nov 2014 19:23:30 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015