PM News/Update. 17/05/2014. Report use Gamon Bridge enter - TopicsExpress



          

PM News/Update. 17/05/2014. Report use Gamon Bridge enter studio say Overah donate another transformer last week for borrowpit after the Gbwa wen e receive from us here. Onome dey ask the community people people to donate another money to instal the transformer again, after dem don donate money before and Financial Sec and the chairman play wayo for the money. The Exco & members for d area dey insist say make Onome give account of how deir money waka, d guy nor fit give account to d community. Since then, e dey go remove borrowpit fuse because say na borrowpit people attack am for the last meeting. U dey feel say u nor dey fear anybody, na vice you be b4, u don fight the two past chairmen because of ur greedness, Mr Appah & Pastor Ajibola nai u use sham for. I dey come for you with Army becos u don turn Transformer issue to ATM for d area. Report enter studio say some of my guys from dis forum go Lagos (Lasgidins) for Chuka wey dey sell Phones for Market, as e dey go do e wife to be introduction for dere. Na Dafe wey dey run, Pere the king of women affairs, Julius wey dey use e mama (Doris) money dey proud, as e don blow e own, Osaro the Audi chairman, Ogharadoro the shortest and mouthed businessman wey lock store for groove, Osie,and Chuka and some of e family members. We dey pray for dem to come back safely. We dey beg the authorities to respond to Ojulu and Ireto axis, we dey plead with Government make dem hear our cry to d effect of d bridge wen cross Ireto and Ojulu as the Bridge don block with dirty and grass and dis dey make houses wen dey dere dey flooded. We don send someone to ask the Councillor wey dey represent the Ward Hon. Kojo Abraham he tell us say he nor get N1.5 Million to bring swambuggy to do d work. We dey use dis update dey call on Hon. Julius Egbedi to address that issue before the Government go render people homeless join the road money wey dem chop. Akponos Sammy say make we helep am hail Uduaghan Park for Sapele manager, say him na man wen sabi and na gud man also. Day before yesterday wen e dey go buy ticket wan go Abraka, e com giv the Girl wen dey sell ticket N500, she say she nor get change, she com write d balance change of N250 for d back of d ticket say if e wan go make e com collect d change but b4 e comot go Abraka, e nor remember collect d change again, na wen e reach Abraka e cum rememba say e nor collect e change, and b4 den e don throway d ticket. so wen e com back to sapele e com go meet d Girl wen dey sell ticket say e nor collect e change b4 e comot and e don lost d ticket, she say she nor go fit giv am change bcos e nor get proof say she dey hold am change as e don lost d ticket, e com sitdown dey watch drama as rain dey fall nai e c d manager, e com report d mata giv am, manager com tell am say na true say she nor go fit giv am d change as e don lost e ticket bcos pipo don use am play wayo b4. But after all said and don e com giv am d change, Apos com tank the manager well well say him na beta manager, though d money small o, but na so dem take dey know beta person dats y we say make we tank the manager specially so dat e go get mind to do more. Today nai Innocent wen dey work 4 International Junior Sch marry one girl wen her name na Susan wen dey work 4 Newspaper Office wey dey Olympia. Na 4 Ughelli dem 4 do d marriage. Drinks go school well. Food dey but d meat dey smell adolic. D rice nor sweet as dem nor use d meat water cook am. Na 4 their nai I 4 c say dem say make every body stand say d couple wan cut cake i neva c am b4 ooo. We use Solo Abeke take wage kola nut for all Arsenal fans as agbekpo Arsenal don manage win FA Cup today. Arsenal use scissors take barber Hull City head today. Congratz to all d Arsenal Agbekpo fans. We nor fit waka round town today due to one wahala wey our studio experiece today. God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Sat, 17 May 2014 20:09:33 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015