SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 05/05/2014. God wey dey up - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. 05/05/2014. God wey dey up know say wetin i wan drop so na for d betterment of evrybody and Sapele in particular. Today e dey good make we dey do things wey go make the people and d environment feel our impact positively so dat we nor go just be like waste for dis life wey we cum leave so. Last week nai report enter my studio say EURAFRIC SAPELE POWER PLC drop many people from work. I nor too shock becos Federal Government don settle all d workers and na base on contract of 6months nai d new company place the workers. When dem do official handovering to d new management i remember wen our King Rtd Major General Mujakpero the Orodge of Okpe kingdom talk during e speech say make the company empower people wey dey the community so dat peace go reign. I dey very happy wen our king talk that thing for e speech. Now the benefit of dat speech don dey manifest it self,as the company declare to the community to produce up to 120 persons for immediate employment for deir security position and according to the report from the company,dem go start deir payment with N25,000. From a very reliable source i don dey hear different talks for deir salaries head. Moses Ogodo i dey call you to order becos i nor wan hear say you slash deir small thing becos u don dey tell some of the boys say deir salaries na N18,000 to N20,000. Wetin dey even dey worry you self? Amuch be N25k wey you wan still slice from? If na you dem dey pay dat amount and dem cum dey cut from the money u go like am? As i dey post dis tin so nor try am bring out dat step becos na my wahala go kill you. Make we dey pity jobless people and make we nor dey take from the poor dey feel say we smart becos na evil act be that and i put am to anybody wey know say na people sweat nai e wan dey use dey hammer na dat money go kill d person. Moses Ogodo the Seplat boys money wey u dey cut from i norva fit forgive you as you dey deny am wit me and many other things wey u dey do wey nor good,now u wan add dis one join. If i swear give you dis morning e go affect your generation. So just adjust ur ways now and stop dis rubbish make we two nor get problem. You wan use dis small money take spoil your new good name wey you been don dey get. Well make i nor too talk now till you mistakingly do anytin to deir salary,but dis post na to stop any yeye plan wey u don already dey wan execute becos i nor wan hear say anytin do our pipo salaries becos when Erhue1 dey talk about the job that time,e nor tell you to cut deir salaries. Anybody wey know say Community dey cut e salary make e run come inbox cum lay d complain,if na any company becos enough is enough of dis carry do and i promise say i go keep your name as secret. Make i go see my Papa for Nikoro Estate first. I remain the Otota1 of Sapele. The Urhukpe1 of Okpe Kingdom. The Asamaigor1 of Itsekiri Kingdom. The Eagle Eyes of Delta State. God Bless Sapele. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Mon, 05 May 2014 06:47:34 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015