SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. HON. GODWIN EBOSA - TopicsExpress



          

SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER. HON. GODWIN EBOSA REPORT. All of for Studio put our knees for ground as we raise our hands up. Dey Praise God for Hon. Godwin Ebosa as e respond well for our Appeal wen we direct to am that Day about say mak e sponsor the Level3 people for HSE Training. Better thing nor dey hide e self,dis na Man wen get the people for heart and he dey use every opportunity wen e get take dey do good. E nor dey mind weda Tribe or family chop alone. I slap u Godwin Ebosa wit Divine favour,i konk you wit Long Live and Good Health mind and body. Dis man tell me for Phone say he go sponsor 30 people from our Studio wit e Company name for e own choice of place. Maybe outside Sapele,Delta State or outside Nigeria. And he cum also promise to retain the people wen pass well for d course wen e wan send dem go. So as unu know na only Graduates nai we announce for dis HSE Level3 progamme. So wetin we go do be say we go pick some names from our people wen go HSE 1&2 and some few once from dis current Level3 Class wit deir Exam score wen dem go do soon. Also we go pik some names randomly from us here,and na base on Certificates, and d qualification wen qualify you na; Master Degree Holder. Bsc. HND. OND. If u qualify just indicate interest and we go from Studio here screen d names again befor we go cum publish all the 30names on Sunday by 3p.m wen go write Letter Of Application For HSE Level3 Training to the Company Awaritse Nigeria Limted. And if unu don write the letter just go drop am for the Company Office wen dey opposite NYSC Secretariat for Shell Road. Unu go drop am dere,and mak unu attach unu Phone Numbers for unu C.V,Email Address,for easy contact if satified worthy for the sponsorship. My people dis na open door for so many of us,so mak we just dey pray mak the Company mark everybody good and at d end dem go retain almost everybody wen we send go and before we know unemployment for Sapele don dey reduce. Dis na d message unu send me report. Make we know say na by Merit and na by how long u don join d forum and d support wen u don put for dis forum to move forward nai merit you,as na those pipo we go first choose befor we go cum begin choose other people join. We don see say many people go just click follow yesterday and for Inbox dem go pack Pls help me for HSE Level3 full everywhere. We know unu,but make unu know say if some people nor stand for our back since we for don loose weight,so those pipo we must giv dem prefrence. If all leaders be like dis Man we for nor dey get problem wit employment. As some Leaders just believe say na only deir Families nai dem dey help,some nor dey even dey helep deir Families. Some just believe to eat alone. Safarians na hand watch hand nai hand take dey clean. Since we start dis HSE Training as the Eagle Eyes Of Delta State i don see say CRIME don reduce for Sapele,as many people don dey get sense and dem dey pass d message of safety act dey give deir fellow Friends wen cum dey understand say Life nor get duplicate. I use dis opportunity to challenge all our Leaders say mak we open our hands to support better things,mak we keep pride aside and mak we know say if we help one person for Life na crowd we dey feed,becos dat person go also try to help somebody else. Unu wen dey do dis Programmes,mak unu know say na pipo dey pay dis morning and d money dem nor pluck d money,so if forum choose you,nor feel say u be super man,use ur slot well becos for d forum to pik u,u don deprive many people. Mak we nor dey go Training late,d tin dey pain me. Mak we take dis things serious as e fit be the opportunity to turn our Lives around,to dat dream person wen we dey aspire to become. Also some of us,just dey go mak,e dey record say SAPELE TAFIA choose me and we nor get mind to use d Certificate take join our oda certificate take work. If wetin dis Man do for us touch you and u happy put,nor waste time throway special greetings and prayers for am,so dat wen e go see am,e belle go sweet am and e go know say yes we sabi appreciate and e go get mind to do more for us. Just drop ur interest under if you get interest,so dat we go begin dey screen from here down. Na me The Otota1 of Sapele. The Urhukpe1 of Okpe Kingdom and the Eagle Eyes of Delta State. NOTE: SPONSORSHIP STILL DEY OPEN FOR OTHER PEOPLE AND AIGEDOSIN SAFETY COMPANY STILL DEY OPEN AS WE GO ONLY SEND OUR BEST FROM HERE GO FOR THIS GENERAL TRAINING. Who God don bless no man fit curse am. God don sign dis forum good weda Man like am or not,we don dey go places and Sapele must return back to its lost Glory. SAPELE/DELTA STATE MUST BETTER.
Posted on: Thu, 05 Dec 2013 05:00:50 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015