Today na today for Calabar as de Naija Supa Eagus go enta de same - TopicsExpress



          

Today na today for Calabar as de Naija Supa Eagus go enta de same trouser with de Flames of Malawi as de two of dem go fite for de ticket wey go carry dem enta de final playoffs stage for de 2014 Fifa world cup wey go shelle for Brazil. Naija wey na dem be de Baba for Africa dey gap all man for dia group with 9points while Malawi dey pursue dem for back as dem don gada 7points. Plenty gbege kon shele bitwin de two coaches as dem jus dey enta each oda anyhow since lass month. Malawi coachi, Tom Saintfiet been carry complain go meet Fifa say Naija coachi, Stephen Keshi dey yab am becos hin no be black man but na "Oyibo pepper" wey supose pack hin bag go bak for Belgium where hin bin come from" But de matter don dey cool down as de two of dem don setul. But Naija coachi kon yarn us for supersport dat him and Oga Saintfiet no get wahala as him tok say him and de Malawi coachi na padi. “The koko for all de tori wey dey ground now na make we waya dem today and I get de confido dat my Boys go tap beta ball for me,”. Naso Oga Keshi tok. Malawi coachi for him own side don dey waka about for Calabar as de oyinbo man dey find plenty sand wey him wan pour for Naija garri as him kuma dey sure dat him Boys go bulala Naija for Calabar. “Me and my Boys no come hia kon drink akamu, but na to carry de 3points wey go helep us reach de ness round na hin we dey find for Calabar,”. Naso de man tok. Na 1-1 draw na hin de two of dem follow diasef play wen dem jam for de fess leg for Blantyre, and na must make Malawi flog Naija today for dem to kwalify. To kwalify enta de final round now dey for de Eagus hand as na draw dem need today for Calabar. Na 4pm na hin de match go take start today for de UJ Esuene Stadium wey dey for Calabar.
Posted on: Sat, 07 Sep 2013 10:23:24 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015