99.5 WAZOBIA FM ABUJA: 9JA HOW UNA SEE AM:- One pesin wey dey - TopicsExpress



          

99.5 WAZOBIA FM ABUJA: 9JA HOW UNA SEE AM:- One pesin wey dey write tori for Punch Newspaper wey him name na, Uche Igwe, don talk say Naija piple no trust each other at all, for Oyibo language say ‘Naija na nest of dishonesty’ and dis man talk say dis lack of trust dey affect everything wey Naija piple dey do badly. Starting from Politics to the way we dey live our lives. This man say trust no dey we society that is why things dey scatter for we country. Him come give example of how piple no trust politicians to rule over dem and even the politicians no trust piple at all that is why any politician wey steal Naija money dey carry am go abroad go invest for another man country and Naija piple go dey suffer for poverty, lack of work and bad government. How u see dis talk wey dey comot from Uche Igwe maut, you believe am abi you no believe am let us know why? LadyG (@ladygdgenius) and Oche dKing (@ochewazobia) dey in da haus. #KuleleZone #9jaHowUnaSeeAm Twitter: @WazobiaFMAbuja Tel: 0709-2222-995 wazobiafm/abuja995
Posted on: Wed, 06 Aug 2014 14:15:20 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015