CONVERSATION BETWEENAIDS & EBOLA..... AIDS: Na who be dis wen dey - TopicsExpress



          

CONVERSATION BETWEENAIDS & EBOLA..... AIDS: Na who be dis wen dey flash me oo? EBOLA: Bro na me ooo, ur sis! I don show. AIDS: Which kind bad market be dis na,waiting carry you come. EBOLA: Hmmmm bros why you dey yarn like dis na, your reign never do you?......Abi na only you dey dis world..i even hear say them don find cure for you. AIDS: So who give you transport come Naija?. EBOLA: Bros na one man from Liberia...him say make i accompany am come Nigeria. As we land, na im i carry my leg waka leave am ooo. AIDS: So hw you wan operate here? EBOLA: I go follow the state wey get thesame alphabet with my name.....Na for those state i go operate high. AIDS: Name the states for me na. EBOLA: Ebonyi,Edo,Enugu,Bayelsa,Bauchi ,Benue,Borno,Oyo,Ekiti,Ondo,Lagos,Abia,Adamawa,Akwa-ibom and Anambra. AIDS: You na baddoo for one side oo, so out of 36 states, na only 15 you fit take...Sister you Tyt,,,,me self i wan upgrade.....Na through Air i want carry dey enter people. EBOLA: Bros you nor get the mind. AIDS: Na market you come spoil me so ooo EBOLA: Bro i be hear say Boko-Haram dey worry for North. E be like say i no go reach dere ooo, i nor wan die young..
Posted on: Mon, 11 Aug 2014 14:52:12 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015