Choi... Achuolam nwanyi chugburu onwem na nwanyi.. ah d play - TopicsExpress



          

Choi... Achuolam nwanyi chugburu onwem na nwanyi.. ah d play secret local gamez.. Bt ah no know say d witch ah call my gf b commander for public international gamez!! She don find out say ah d chyke anoda girl.. Nd me kom find out say she b #pure witch..infact she b witchcraft Im self !! Ah don kneel down beg am say make she d go..ah no want her again.. She tel me say na lie..dat wan can neva happn, she tel me say na she chyke me..no b me chyke am..nd na she b d wan wey go dismiss me anytym wey Im feel lyk!!! Hei... Ah don suffer oh.. 4 day tym, whn ah call am 4 phone..tel am make Im kom so dat we go make love to each oda..she go say am nt in d mood,dat shez nt komin. Bt at night, 4 my dream... na Im d love makin go start..nd afta evri evri, ah go kom d fly internationally 4 air!!! Hmmmm..anwuola mu oh! Bt if una c diz girl! GOD4bid,hu b girl, if una c diz witch eh.. U go fall in love wit am sharp sharp[no dullin] !! Bt ah no want am again ohhhhh... Na waitin my EX dey cos, if to say she still dey wit me now.. Dix kind tin no go happn to me! Thunda go just calm down freestyle dat my EX for me..cos na she put me 4 diz international witch craft love makin relationship business! Yes ah call am dat name bcos truly truly, na pure biz wey she dey do wit me! Bt wan tin wey ah lyk 4 diz relationship b say ah no dey stay broke..tah..thunda fire brokeness!! Ah dey stay on from night to night!! Imagine d witch wey ah go call for phone say make she kom give me smetin wey go swt me[make she kom give me d sugar dat swt low] she no go kom dat tym, na for my dream wey she go kom!! And afta dat, d next day..she go kari money kom give me say diz na my own share!! One oda tin wey ah take lyk diz biz b say na me d take d lion share!! Hei..too much money!! Bt ah no want am again oh.. Ah no nid d biz nd d relationship nd d love makin again oh.. Pls diz are my real namez marcellinus uzoma norberth pls just take d name nd start prayin 4 me, GOD go bless u!! Evn if ur papa or mama na spiritualist..abeg no waist tym,just kari my name go give am.. Make Im begin work coz time adirozikwa!! Ah don kneel down pray to GOD 4 forgveness nd 4 my stupidity,.make Im kari diz tin komot 4 my syd..ah no do d biz nd d etc again! Bt GOD kom tel me say na joke ah d joke. Make ah continue wit d biz..big money dey insyd! Im say na next year wey Im fit do smetin abt it... Fit oh no b say Im go do am oh!! Abeg na guys only wey ah nid 4 diz prayer.. Girlz nd witches, ah don tire 4 una..make una no try put mouth 4 diz prayer oh!! B4 chineke elebara unu anya! #una prayerz abeg#. No b jokin mata oh, ah d talk am now Im go b say na funny stuff.. Abeg no funny mata oh..am seriously serious
Posted on: Sun, 24 Nov 2013 13:24:50 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015