Ehe! Thank you very much! Una answer well! Because una don answer - TopicsExpress



          

Ehe! Thank you very much! Una answer well! Because una don answer well, I get another question. Abeg make una no vex oh intelligent ones! The thing be say I bin want ask say for Africa, when a woman born pikin and her mother in law visit and the woman wey born pikin still very very very very very very weak, who dem go look after? And even if im mother in law no want help because obviously she no be im pikin, who go do the work in the house(no house girl around) the weak woman or her husband? Who go chop food wey a weak, dying woman cook? Me I no fit oh! God bless you as you answer.
Posted on: Mon, 17 Jun 2013 07:16:15 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015