Emeka Okeke: Igboistical igboistic igboist make una help me - TopicsExpress



          

Emeka Okeke: Igboistical igboistic igboist make una help me tank baba GOD wey save my life today oh,i close from my shop dis evening na ein i come drive com enter for one joint say make i go buy take away food wey i go eat for dis nite as e be say i still be bachelor wey never ready to marry,on my way to my house na so my car fail brake on top of speed oh,nearly my car for enter under trailer wey carry petrol na ein i com use the speed go hit PHCN pole before my car com stop,even up till now my body still dey shake becos dis one na my first experience to excape accident,but wetin dey pain me wella wella, be my front car wey be my baby and companion damage beyond repair,make una follow me tank baba GOD say i no kick bucket go join my ancestors, the same GOD wey make me to survive boko haram for this borno state still dey for my side,papa GOD dalu emela oh.
Posted on: Mon, 11 Aug 2014 18:29:33 +0000

Trending Topics



Recently Viewed Topics




© 2015